You are here: HomeAfricaBBC2021 05 14Article 1261771

BBC Pidgin of Friday, 14 May 2021

Source: BBC

14th May be public holiday for Nigeria?: See states work resume on Friday afta public holiday for Eid-al-Fitr

Muslims don celebrate Eid-al-Fitr on May 13 after 30 day Ramadan fasting Muslims don celebrate Eid-al-Fitr on May 13 after 30 day Ramadan fasting

Work resume on Friday across Nigeria except for states wey declare May 14 public holiday to continue di Eid al-Fitr.

Nigeria Federal goment bin declare Wednesday 12 and Thursday 13 May, 2021 as public holidays to mark di end of Ramadan.

Apart from Kano and Niger State wey declare Friday work free day, work dey resume across di rest 34 states including Abuja.

Minister of Interior Rauf Aregbesola for di earliier statement wey im bring out also "congratulate Muslim faithful on di occasion.

Aregbesola call on all Nigerians, for home and abroad to use di period of dis year Eidul-Fitr celebration to pray for di kontri."

But some states extend dia public holiday till Friday as dem declare work-free day.

"Governor Abdullahi Ganduje of Kano state don declare tomorrow Friday, May 14 as work free day to allow Muslim faithful continue with di Eid-el-Fitr celebrations," Muhammad Garba, Commissioner for Information, Kano state tok for statement.

Garba say di decision na as dem consider say Wednesday, May 12, wey Federal goment bin declare follow for inside di Ramadan period wey make di fasting complete 30 days.

Also, di Jigawa state goment declare Friday as work free day.

Hussaini Ali Kila, di Head of Civil Service for Jigawa state for di statement wey im sign tok say Govnor Badaru Abubakar "congratulate Muslim faithful on di Eid-el-Fitr celebration and make civil servants use di period of dis year occasion to pray for peace, stability and economic transformation for di State."