You are here: HomeAfricaBBC2021 04 07Article 1226635

BBC Pidgin of Wednesday, 7 April 2021

Source: BBC

Unknown Gunmen attack anoda police station for Imo state 'We still dey hear gunshot' - Witness

Unknown gunmen attack police HQ wey dey Ehime Mbano local goment area of Imo state Unknown gunmen attack police HQ wey dey Ehime Mbano local goment area of Imo state

Some unknown gunmen on Tuesday attack di Area Divisional Police Headquarters wey dey Ehime Mbano local goment area of Imo state.

Dis dey come a day afta dem carry out similar attack for di state police heaquarters and di prison wey dey Owerri, di state capital

Di toktok pesin for di state police command wey confam di attack say no police officer die for di incident but di gunmen burn three vehicles.

South East don suffer well well sake of violence- Vice President Osinbajo

Wetin Govnor Uzodimma tok about Owerri prison break

For one video wey one Facebook user post, bin of di community bin dey try to put out di fire wit bucket of water.

''We still dey hear gunshot'' Witness

BBC contact one Ehime-Uboma indegen wey dey liev for di community at about 7:20pm wey confirm di incident.

Di eyewitness tok say, "I no know how many di boys dey but dem first begin shoot wey make everybody run before dem enter di police station.

" As I dey talk to you know we still dey hear gunshots. E be like sey security pipo don come to pursue dem.

Everybody dey hide for im house.' she tok.