You are here: HomeAfricaBBC2021 03 29Article 1218277

BBC Pidgin of Monday, 29 March 2021

Source: BBC

10 gunmen attacks on Police officers for eastern Nigeria under three months

Gunmen don dey attack police for southeast since early 2021 Gunmen don dey attack police for southeast since early 2021

BBC Pidgin don find out how much damage don happun in three months for South East Nigeria sake of gunmen attacks on police officers.

Police for South East Nigerian don suffer di highest form of attacks from unknown gunmen for di last three months, BBC reports.

Dis one follow for di compilation of all di attacks wey tori pipo don report and authorities don confam.

Di attacks range from burning of Police Stations, ambush and shoot-out with Officers, burn police stations and patrol vans, helping prison inmate to escape and stealing of arms and ammunitions for virtually all di states for South-East.

From our record Enugu na di only State wey never record any gun attack for di last three months but other South Eastern States of Abia, Imo, Anambra, and Ebonyi don get very bad experiences with dis gunmen wey we never sabi.

Breakdown of armed men attack on Police Officers for South East Nigeria between January-March 2021

Ebonyi State, January 8

3 Police Officer die

Onueke Police Station in Ezza South Local Government Area



Abia State, February 1

1 Police Officer die

Omoba Police Station in Isiala Ngwa South council area


Ebonyi State, February 4

Police Station burnt

Police Divisional Headquarters in Isu, Onicha Local Government Area


Imo State, February 5

2 Police Officers die

Umulowo Police Division in Obowo local government Area


Abia State, February 23

2 Police Officers die

Abayi Divisional police Headquarters in Aba


Imo State, February 25

Police Station burnt

Aboh Mbaise Divisional Police Headquarters


Ebonyi State, March 1

Police Station attacked

Iboko Divisional Police Station in Izzi Local Government Area


Imo State, March 9

Police Station burnt

Ihitte-Uboma local government Area


Anambra State, March 18

1 Police Officer die

Police checkpoint at Neni , Anaocha local government area


Anambra State, March 19

1 Police Officer die

Ekwulobia Police Station, Nanka


Abia State, March 22

3 Police Officers die

Abiriba in Ohafia Local government area


BBC never fit independently verify di number of Police officers wey don die for di attacks but authorities don show concern about di number of officers wey don fall victim of di attacks.

Over di weekend Nigeria Police Force come out come tok say dem don arrest 16 suspects wey get hand for di plenti violent attacks on security operatives and facilities for some states particularly for South-Eastern part of Nigeria.

Oga Muhammed Adamu, Inspector General of Police, say dis arrest na di result of di hard work of Police officers wey collabo with di Army and Air Force to gbab those pipo wey dey responsible for di new trend of attacks on security personnel.