You are here: HomeAfricaBBC2021 03 19Article 1209028

BBC Pidgin of Friday, 19 March 2021

Source: BBC

Port Harcourt Refinery: Nigeria biggest oil refinery wey goment approve $1.5bn to rehabilitate

File photo of a refinery in Ghana's industrial hub of Tema File photo of a refinery in Ghana's industrial hub of Tema

Di Nigeria Federal Executive Council approve $1.5 billion to sharply begin di rehabilitation of di biggest refinery for di kontri - Port Harcourt Refinery Company - and dis decision don generate different kains of reactions from Nigerians.

While some dey get hope say dis time di rehabilitation go work, oda believe say dis na repetition of goment intervention wey no dey eva work.

Nigeria, one of Africa biggest producer of crude oil, don dey struggle for many years to maintain im four refineries wey de located for Port Harcourt, Kaduna and Warri; and ova di years different leaders don announce plans to rehabilitate dem but dem no eva succeed.

Di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN), dey totori say di $1.5 billion loan wey di goment collect to repair di Port Harcourt refinery na based on di condition say na private sector must to manage am.

National Operations controller of Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN), Mike Osatuyi, tell BBC say wetin mak dis decision "very good wey make us get confidence be say di Minister say dem give di loan on condition say private sector must to manage am afta dem rehabilate am and dat give some hope say e no go go as usual becos nobody go prove to me say all di repair wey we don dey do di moni no be waste."

According to di Minister of state for petroleum resources, Timipre Slyva, na one Italian company Tecnimont SPA, go do di rehabilitation and e go happun in three phases; di first go end in 28 months, di second in 24 months and di third phase go finish after 44 months.

Oga Osatuyi say dem get hope dis time becos na private company. "Private system go do di work sharp sharp, but if na goment e go take dem many years to do di rehabilitation becos goment dey come and go and dem dey change policy from time to time," im tok.

But di former vice-president of Nigeria, Atiku Abubakar, describ di goment decision as "suspicious."

Im argue say, di kontri dey for "critical period" right now wit unemployment rate increasing to 33% and inflation don hit 17%, so dis na time to manage any income wey di kontri generate and even If dem go borrow dem must do am responsibly.

So na wetin be di facts wey dey make Nigerians react to dis goment decision?

E no dey make moni

Port Harcourt Refinery Company for Rivers state south south of di kontri na di biggest refinery for di kontri. Di company get two refineries; dem commission di refinery for 1965 while dem commission di second one thirty-two (32) years ago for 1989.

Di refinery like all di oda refineries for di kontri don dey out of service and e neva make any moni for so many years now. For 2019, di refinery lost 167 billion naira.

Pipo wey dey against to rehabilitation dey argue say e no make sense to put moni for wetin don die.

Vandalise pipeline

E dey very difficult to send crude oil to di refineries becos vandals don completely scata di pipelines.

For many years hoodlums bin de yenta inside bushes and forests wia pipelines run through for different parts of di kontri to destroy den steal crude and refined oil.

Turnaround maintenance

This no be di first time wey goment dey do throw moni to rehabilitate di PH refinery.

None of di refineries don get any serious maintenance service since 2008, di last turnaround maintenance happun for 2000.

For 2019 di Nigeria National Petroleum Corporation announce say dem don begin first stage of rehabilitation of di PH refinery.

Dis work wey suppose be major turnaround bin dey come 19 years afta di last turnaround.

So far, di kontri don spend reach about $25 billion for turnaround maintenance inside 25 years according to Business Day.

Sell refineries to fund 2021 budget

E neva too tey wey goment bin decide to sell more dan 36 of im properties including di three refineries to finance di 2021 budget, but now dem decide to maintain di PH refinery.