You are here: HomeAfricaBBC2021 05 31Article 1274836

BBC Pidgin of Monday, 31 May 2021

Source: BBC

Nigeria police say dem no get hand for 'Sowore shooting'.for Abuja

Tori spread for social media say na police shoot at Sowore Tori spread for social media say na police shoot at Sowore

Nigerian activist, Omoyele Sowore post for im social media page allege say police shoot am for leg on Monday.

Sowore wey dey ginger for "Buhari Must Go" protest, tweet say police officers shoot at am for Abuja Unity Fountain in di morning.

But di police say dem no get hand for Sowore shooting.

Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.

Di 50 year old publisher of Sahara Reporters bin don dey ginger for one "#RevolutionNow" protest for Nigeria since August 2019.

Sowore allege say as im pipo dey try organise one protest waka on top security mata for di kontri. Before dem go know, dem hear gunshot, and then di bullet hit Sowore for leg.

Di tori be say, Sowore and oda protesters bin land di Unity Fountain in di morning wia dem go wait for di entrance.

For Twitter post Sowore show picture of im injury and also call on di struggle to continue even if dem kill am.

Abuja police tok tok pesin, Yusuf Mariam explain say di police professionally restore calm afta some group of protesters dey try incite public  disturbance.

Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.

She further explain say di protesters action fit cause di breakdown of law and order.

Di police tok tok pesin also urge Abuja pipo make dem liver no cut dem and make them remain calm.

Di command dey do everything possible te ensure the safety of dia lives and property, Yusuf Mariam add.