Wrestling legend Hulk Hogan don die at di age of 71.
Hogan na legendary WWE wrestler and actor wey don totori pipo for dia youn age.
Statement by di WWE for dia X page on Thursday, announce di death of di wrestler.
"WWE dey saddened to learn say WWE Hall of Famer Hulk Hogan don pass away."
"One of pop culture most recognizable figures, Hogan help WWE achieve global recognition for di 1980s."
WWE send dia condolence greetings to di 'family, friends, and fans.'
Hogan, real name na Terry Bollea and e be one of di biggest professional wrestlers of di 80s and 90s wia e also achieve more fame.
E first enta wrestling for 1977 and become ogbonge figure of di industry.
Hogan kontinu dey fight wrestling until e enat im 50s and for 2018, dem reinstate am into di WWE Hall of Fame afta dem comot say e use racist slur.
Hulk Hogan biography & profile
You fit argue am say Hulk Hogan na one of di most popular name for professional wrestling history.
Dem born am as Terry Boella for 1953. Hogan bin dominate di professional wrestling world throughout di 80s and 90s bifor e waka go into feem, and later reality TV.
Wen e join di World Wrestling Federation (now World Wrestling Entertainment, WWE) for 1979 bifor e comot shortly afta for 1981, Hogan be di first WrestleMania for New York for 1985, wia e and Mr T bin defeat Paul Orndorff and Roddy Piper.
Throughout di 90s, Hogan popular for inside wrestling ring, bifor e come dey appear for feem wey include Mr Nanny and Suburban Commando.
Dem inducted Hogan into di WWE Hall of Fame for 2005 (and later again for 2020 as a member of di NWO). But dem remove am from di hall for 2015 wen dem end im WWE contract sake of a tape of am wey show wia e dey use racist slur.
For 2018, di company return am back to di Hall of Fame, wia dem say e deserve a second chance, but several WWE superstars, including di New Day and Titus O'Neil, e no go easy to forget wetin e do.
For recent years, Hogan bin appear for Trump rallies and on di US election campaign trail last year.
Hogan video wia e slam Andre the Giant go foreva dey for wrestling history, as di title also last for more dan three years.
WWE is saddened to learn WWE Hall of Famer Hulk Hogan has passed away.
— WWE (@WWE) July 24, 2025
One of pop culture’s most recognizable figures, Hogan helped WWE achieve global recognition in the 1980s.
WWE extends its condolences to Hogan’s family, friends, and fans.











