You are here: HomeAfricaBBC2023 04 06Article 1744886

BBC Pidgin of Thursday, 6 April 2023

Source: BBC

Woman wey doctors give short time to live believe in ‘miracle’

One Nigeria woman, Fikayomi Aaron One Nigeria woman, Fikayomi Aaron

One Nigeria woman wey doctor say no get many years to live sake of her health condition say she believe in "miracle".

Fikayomi Aaron dey suffer from Heterotopic Ossification, na disease wey affect her muscles, soft tissue and e don make her joint stiff.

She also get Peritoneal Calcification, Gross Ascites, and Hepatomegaly wey dey make her stomach big.

Tori be say dem no born Fikayomi wit dis sickness, e start wen she be 10 years like tumour for hip bifor e spread to her hand.

"Nothing fit make me deny di power of miracle becos me as I dey alive today na miracle," Fikayomi tok

Now 30, Fikayomi reveal say she don reach di point of death many times including attempting to take her own life.

Dis sickness don affect her quality of life, she no fit waka, or do tins for herself.

Na her mama dey assist her to do evri tin from to waka, to baffing and even carry her comot from bed.

Di sickness no dey allow her use her fingers or bend her leg.

‘I still believe say I get future’

Despite all her of health challenges 30 year old Fikayomi, don achieve some of her personal goals.

"I be author, writer and digital book publisher," she tok wit smile for her face.

She say she gada all dis skill through online courses wey she take part in and attending seminars.

"Wit all my limitations I still believe say I get future," she add.

Di future wey Fikayomi dey see for herself na to reach out to young pipo to help dem find purpose for dia life .

Wetin be heterotopic ossification?

Heterotopic ossification (HO) mean say di bone dey grow in tissues wia typically e no suppose.

Di bone fragments na extraskeletal bone.

Dem dey often form afta pesin get injury. But dem fit occur for no known reason.

Wetin be di types of heterotopic ossification?

Nongenetic: Dis one dey affect pipo of all ages. Sometimes dem dey happun wit no known cause. More often, na response to some sort of trauma. Dat trauma fit be injury or e fit be trauma of surgery.

Genetic: Dis type no dey common. Genetic types dey more likely to come from malformations for your spine, hands or feet. Genetic heterotopic ossification dey severe.