You are here: HomeAfricaBBC2023 10 11Article 1860392

BBC Pidgin of Wednesday, 11 October 2023

Source: BBC

'Wia you fit hide wen death dey come from di sky?' - Life for Gaza

Gaza afta di strike Gaza afta di strike

"Wit evri strike, e be like earthquake dey hit di building - I dey feel my heart do gbim gbim gbim wit fear and my whole body," na wetin Nadiya wey no wan tok her real name, tok.

On Monday morning, na di sounds of doors and windows breaking na im wake up Nadiya, she say "di shelling bin start for 8am for morning and kontinu till midnight. E no even stop for one second."

Di mama of two boys, one wey be five years old and di oda wey be three months bin dey stay for one flat wey her family bin just buy and decorate. Na only she dey house wit di boys on top say her husband, wey be doctor wit international aid joinbodi dey outside dey help pipo wey injure.

Her older son bin ask her wetin dey hapun, wen e go end and Nadia say wetin she tok to calm am down na to say "to hear di sound of explosion dey come seconds afta e don happun" and say dat na how dem fit know say dem dey safe.

Na di kain tin wey five year old pikin no suppose sabi but Nadiya say na di best way wey dem fit cope for now.

Di explosions still dey cause heavy kasala becos her three month old boy dey get seizure and dey refuse to chop.

For di past few days, Nadiya say she no go comot her house sake of say "evri corner get memory". But on Monday night, she hear her neighbours dey run kiti-kata shout "Evacuate! Evacuate!!"

Di young mama bin pause small, as her brain dey do gymnastics for wia she go run go, den wit fear and helplessness, na so she start to dey cry.

She comot di building wit her two pikin dem but she say she no fit recognize di oda buildings for her area as dem don level dem.

She, as at now, dey try to safely find her way go her parents house but her question be say, "wia you wan hide wen death dey fall from sky?"

Nadiya and oda Gaza residents wey di BBC follow tok say di kain damage wey Gaza don already go through dey very plenty.

'No place is safe in Gaza'

For di rich area of Rimal, 39 year old Diner dey hide from Israeli airstrikes wit her mama, papa, sister and two nephews dem for dia villa wey get garden. Dis area na usually quiet residential area wey dey about 3km from di city centre.

On Monday afternoon, di family start to dey hear heavy shelling for di neighbourhood.

Dina say, "we bin tink say we dey safe for di house but all of a sudden, di window break finish and di doors fly comot. Paart of di roof sef fall on top our head."

Dem say shock catch dem but dem remain inside di house wey don spoil finish as six more air raids hit di area.

Once e quiet small, na so Dina and her family leave dia load run for dia lives.

Dem run enta hospital wia dem treat dem for dia wounds. Dina say dem lucky say dia wound no deep.

Wen dem go back house to go pack load, na so dem see say e don fall yakata. Now dem dey stay small wit anoda family and Dina still dey try recover from di shock of "losing our home, memries, and di place wia we bin dey feel safe. No place dey safe for Gaza."

Hospitals dey struggle to save lives

For Alshifaa hospital, wey be di biggest hospital for di region, chairman Dr Mohamed Abo Suleima say di mata don red.

"At least 850 pipo don die and more dan 4,000 dey injured", na so e tok.

Di hospital dey rely on generators since dem don take light for di area and dem only get enof electricity wey go fit last dem for like three more days, na so im tok.

As Israel announce full blockade for Gaza, desalinated water don scarce for di hospital.

Dr Abo Suleima say dem dey put life saving cases for di top of di list of priorities wey dem go se clean water, and dem don close oda departments for di hospital so dem go fit save lives.

Di doctor dey fear for di safety of im patients as well as im staff. E say dem dey target ambulances and dem don kill one doctor as e dey go di hospital.

According to di UN Palestinian refugee agency (UNRWA) 187,000 Gazans don run comot dia house dey find safe palce to stay.

As heavy bombing dey kontinu, di agency don manage to house 137,500 pipo but dem dey worry say dem fit reach full capacity

Empty shops

Ishaq, wey be 27 year, bin dey live wit im old mama, papa and sister-in-law wey get five pikin for Shujaiyya. Afta Israel Prime Minister Benjamin Natanyahu tell im kontri pipo say dem dey enta "long and difficult war", afta di Hamas attacks for Saturday, Ishaq and im family quickly grab wetin dey happun.

Dem carry dia must valued load and as every of dem dey carry small back, dem go find shelter for city centre.

As dem dey go, di 20 family members bin go market to buy tins like groceries but shops bin dey almost empy sake of say many Gazans bin don already code say sometin dey sup so dem rush to stock up afta dem hear of Saturday attacks.

Dem end up for inside air raid shelter wia dem dey hide, e dey residential building for centre and dem dey dia with oda families dem.

Ishaq say, "we dey dia for two days wit no electricity and no water". Den, on Monday evening, e hear informate from di Isreali army say make dem comot di building for midle of night. Na di light of di air strikes show dem dem road as dem dey run.

"All we dey see around us na di buildings wey don scata."

Dem waka to di north of di city centre to one of di residential areas wey usually dey quiet, but for dia sef dem see say "most of di buildings na for ground we find dem"

Ishaq and im family don dey hide for over 12 hours for di dark lower ground floor of one building wey neva fully fall wit 10 oda families.

E say "we dey live in fear of wetin go happun in coming hours and we dey pray togeda for safety." Dem no know wetin to do or wia to go next.

(None of di pipo wey follow BBC tok bin want make we use dia picture)