Tok-tok pesin for Los Angeles Department (LAPD) say around 05:30 (12:30 GMT) on Thursday, some pipo call police to come Ventura Boulevard becos of one man wey wear im underwear dey waka down di streets.
Afta di officers arrive for di area, LAPD allege say di Old Town Road singer "charge" go meet dem, dem add say dem place am under arrest on suspicion of battery.
Dem carry am go hospital for treatment for possible overdose, police tok-tok pesin Charles Miller tok.
BBC don reach out to im representatives for dem to chook mouth on top dis mata.
Videos wey BBC no fit verify wey TMZ publish of di star on Thursday morning , show as di singer dey dance for street wit just im pant and cowboy boots, im even dey invite pipo wey dey pass to "come to diparty".
Di rapper dey expected to release im much-anticipated second studio album Dreamboy later dis year, im bin tease im new music on Instagram ahead of di drop.
Who be Lil Nas X?
Lil Nas X wey im real name na Montero Lamar Hill, na ogbonge American singer.
Di ogbonge American singer become di first openly gay man to receive a Country Music Association award, afta im win wit Old Town Road for 2019.
Di song also win two Grammys and break record for di longest-running number one song on Billboard Hot 100, afta 17 weeks for di top of di charts.
Tori be say dis no first time wey di singer dey find imself inside controversy for im career, di conservatives for US call di music video for im hit single Montero (Call Me By Your Name) "depraved" and "evil".
Di singer respond wit one fake apology video for YouTube, wey cut into Montero infamous lap-dancing scene, and den im write for Twitter say im want im haters' tears to "fill im Grammy cup".











