You are here: HomeAfricaBBC2023 10 10Article 1859786

BBC Pidgin of Tuesday, 10 October 2023

Source: BBC

Why e take Israel long time to deal wit Hamas attack from Gaza?

Israel don put more tanks and men for di border wit Gaza Israel don put more tanks and men for di border wit Gaza

Wia di Israeli Defense Forces bin dey, for hours as Hamas militants dey roam around communities near Gaza, na di kwesion some pipo dey ask.

"Di army fail completely as quick-reaction force," na so one Israeli tok, pointing to how some of di communities wey come under attack gatz rely on dia own civilian protection forces as dem bin dey wait for di military to arrive.

Di full answer of why dis thing happun go take some time to come out. But e dey like surprise, sake of how di speed di attack shock di defence, wey bin no dey prepared for wetin dem face.

Di surprise element bin dey key for di Hamas attack.

Israeli intelligence fail to get inside Hamas planning for dis attack. E look like di group use dia long-term programme of deception to give di impression say dem no dey capable or dem no dey ready to launch any ambitious attack.

Dem also practise good operational security, and probably off all electronic communications.

Hamas rely on dia speed for dis attack to reason wetin fit happun next.

Dem launch thousands of rockets as cover. But dem also get drone strikes for di monitoring equipment wey Israel dey use for di border fence to watch wetin dey happun. Heavy explosives and vehicles create as many as 80 breaches for di security fence.

Dem also use motorised hang-gliders and motorbikes, na between 800 and 1,000 armed men come out of Gaza to attack multiple sites.

Dis kain tactics work as e overwhelm Israel defence dem - at least for a while.

Dis kain tactics go don cause wahala within Israel command and control centres, wey bin dey quiet on Saturday morning wey also be religious holiday.

Some of di Hamas fighters bin target civilian communities while odas target military outposts. Dem shock say di security for di outposts bin no tight, as photo begin spread to show Israeli tanks for Hamas hands.

And di holes for di border bin dey open for long time wey allow dem to take hostages go Gaza before dem eventually use tanks to close am up.

Dia Defence bin no too tight –Tori be say recently Israeli security and defence forces dey more focused for West Bank rather dan Gaza, na wetin wey fit don dis kain gaps. And Hamas fit don use di divisions wey dey ground for Israeli sake of Prime Minister Benjamin Netanyahu policies to further distract di security establishment.

Many pipo rate Israel military and intelligence capability as di best for di Middle East and one of di best for di world. But dem fit don also underestimate di abilities of dia opponents.

Some pipo dey compare dis attacks to di one wey bin happun for 9/11 for US, wen nobody bin predict say dem fit use planes as weapons. Dat one dem bin call "failure of imagination".

And na di same failure of imagination wey also fit be one of di issues for Israel, wey catch dem unaware for something wey dey so ambitious from dia enemy.

These concerns go certainly dey part of di long-term inquiries wey go likely take place. For di short term, dia focus go be to work out wetin dem go do next instead to lookback.

Gaza go 'soon dey without fuel, medicine and food' - Israel authorities

Di Gaza Strip go soon face serious humanitarian crisis if supplies stop to come in, authorities tok, as Israel responds to di Hamas attacks.

On Monday, Israel declare "complete siege" for di territory, dem say dem go cut off electricity, food, fuel and water.

According to residents, aid neva come since Saturday.

BBC footage show empty streets wey dey covered wit rubble from collapsed buildings sake of Israeli airstrikes.

Nearly 700 pipo don die for these attacks and thousands more dey injured.

Na about 2.3 million pipo dey live for di area in total - 80% of dem dey rely on humanitarian aid sake of di ongoing fight-fight wit Israel.

Na Hamas militants dey ruled dia but Israel na im dey control di airspace and di water. Dem also dey restricts who and di kain goods wey fit cross di borders.

Dia Neighbour Egypt dey strictly controls who or wetin fit pass through dia border wit Gaza too.