You are here: HomeAfricaBBC2023 10 25Article 1868975

BBC Pidgin of Wednesday, 25 October 2023

Source: BBC

Why court Sack Ghandi Olaoye as Soun of Ogbomoso

Ghandi Olaoye Ghandi Olaoye

Oyo State High court wey siddon for Ogbomoso don upturn di appointment of di new Soun of Ogbomoso, Oba Ghandi Olaoye, sake of illegal selection process.

For im judgment, Justice Adedokun tok say di appointment of Oba Laoye dey illegal.

Di court den order make Oyo state goment conduct fresh selection process to select new king for di South-west town.

Dis na afta di Oyo state goment bin announce Pastor Ghandi Olaoye as di new Soun of Ogbomoso and make am king on di 8 September 2023.

Na one of di contestants for di stool Kabiru Laoye bin file suit to argue say Olaoye appointment as Soun dey illegal.

Justice Adedokun also throway di three petitions wey one of di accusers, Prince Taofiq Laoye bin bring against am.

Di petitions also dey challenge di appointment of di new Soun.

Afolabi Ghandi Olaoye bin emerge as di Soun of Ogbomoso for September 2023, one ogbonge traditional position for Oyo state, South west Nigeria.

Di state Govnor Seyi Makinde na im give di approval for Ibadan, Oyo State capital.

Olusegun Olayiwola, di Commissioner for local goment and Intelligence Affairs make di announcement for statement e release For early September.

Olayiwola bin say di announcement come afta long selection process wey law mandate di state to follow - “His Excellency congratulate di new Soun-elect on im ascension to di throne of im forebears,” e bin tok.

Kasala bin dey among di royal families for Ogbomoso over who go take over di stool afta di former Soun die since two years ago.

Until im selection as Soun, oga Olaoye na di Pastor of RCCG Jesus House, Washington DC United States of America.

Im dey married to Pastor Mrs Omo Olaoye and dem get two daughters.

Im background show say im study English Language for im first degree and Industrial and Labour Relations as im second degree. Im get oda degrees in oda fields.

Na 1992 e become pastor for RCCG but bifor den im bin dey do business.

Unlike im papa wey try to be King for 1940, prince Olaoye bin don always maintain say im no get interest for Kingship. But as time dey go on, e say God give am message about di stool.

Sake of say im don spend most of im adult life as pastor, oga Olaoye bin tok say im go retire as clergyman wen e reach 60 years until di traditional position come.

Pastor Ghandi don lead RCCG churches for three kontris – Nigeria, Germany and United States. Dis na apart from all oda kontris e don travel go do God work.

“Pastor na shepherd, a traditional ruler, mayor, king or even governor – all of dem be shepherds.

But we as pastors na shepherd for local congregation but king na shepherd of a city. Di major difference na say di pipo wey dem dey lead dey different,” na so Pastor Olaoye tok wen dem ask am about how im go handle im new position as traditional ruler.