BBC Pidgin of Friday, 11 July 2025

Source: BBC

Why controversial Ablekuma north dey do rerun elections six months after di December 2024 vote for Ghana

Di electoral commission dey rerun election for 19 out of over 230 polling centers in Ablekuma North Di electoral commission dey rerun election for 19 out of over 230 polling centers in Ablekuma North

All eyes go dey for one constituency for Accra - di Ablekuma North constituency on Friday 11 July 2025 as di electoral commission for Ghana organize election rerun for dia.

Di kontri election management body announce say dey go rerun di polls for 19 out of di 281 polling centres sake of dem no fit authenticate di results for dis places.

According to di commission, both di goment party di national democratic congress (NDC) and di opposition new patriotic party (NPP) no gree for di results of plenty polling centres during di collation.

Di goment party NDC tok say di electoral commission gatz do rerun di vote for 37 polling centres sake of result sheets wia di EC bin use for collation, na scanned copies wia di opposition NPP don present.

Di NPP also tok say di goment NDC agents bin verify those scanned copies dem present wey dem carry collate di votes afta di election.

Na so di only centres wey dey outstanding na 3, wia di electoral commission gat to collate and declare di winner.

But di electoral commission inside one statement on 2 July tok say dem go return di vote for 19 out of di 37 centres.

"Di commission bin arrive at dis decision sake of di 19 scanned copies of di result sheet wia dem use for di first collation, no dey verified by di presiding officers for those polling stations."

Di commission add say "for some 18 polling centres, our presiding officers don verify wia dem confam results on top di NPP scanned sheets, wia di agents of di candidates all verify dem also."

So for those polling stations "we no go rerun di elections for dia."

Since di commission announce di 11 July rerun of di elections for Ablekuma north, di goment NDC bin dey campaign for dia to ensure say dem go win di seat to add to dia 188 seats for parliament.

Opposition disagree wit electoral commission rerun

Di NPP candidate for di 2024 election Akua Afriyie say na she bin win dat elections wit ova 400 votes.

During di kasala afta di elections, dem bin go to court wia di court tok say make di electoral commission collate di rest of di results at dat time and declare di winner.

But every time di EC go try to gather diaserf to collate di results, chaos go breakout and dem go suspend di process.

For one press conference afta di electoral commission announce say dem go rerun di vote, tok tok pesin for di party Justin Kodua tok say "di NPP go boycott dis election rerun."

Im argue say dia candiate already bin win di votes wia if di commission go according to di court order wia dem collate di votes, dia candiate Akua Afriyie go win.

In fact, di party don enta di high court again afta di electoral commission bin announce di 11 July rerun.

Di NPP bin dey ask di court to stop di election rerun for Friday for 10 days until di court go settle on top dia substantive mata.

But di high court don dismiss di injunction application by di NPP candiate Akua Afiyie.

Dat decision mean say di 11 July election rerun go happun.

Di party executives bin tok dia members say make dem boycott di polls.

Dem also describe di electoral commission boss and her deputies say dem dey incompetent wit di way dem handle di constituency election kasala.

"Wetin di electoral commission don dey do na contempt of court. Di EC gat plenty questions to answer, dia u-turn for dia mata no dey make sense."

Im also add say "dis na shame for di EC but for us in di NPP we sabi say our candidate bin win di election wit 414 votes."

But for one sharp twist, di candidate herself Akua Afriyie don tok say she go contest for vote, contrary to wetin her party executives bin tok.

Already di NDC candidate Ewurabena Aubyn and her party pipo bin dey di constituency to campaign for votes ahead of di Friday 11 July election.

Dis two women go try one more time to see if di pipo of Ablekuma North go vote for dem to win or not.

Di electoral commission say dem dey ready to organize di polls on Friday wit support of di security agencies.

Chaos happun afta di voting, angry supporters burn electoral materials

Afta di elections on 7 December for di Ablekuma north constituency, kasala don happun.

Thugs wey pipo sabi as angry party supporters bin storm di collation center wia dem attack EC officers.

Dem destroy di result sheets of di officers wia dem carry some of di ballot boxes away.

Na so many of di presiding officers don lose dia result sheets.

In fact, one basic school wey dey close to di collation center wia dem keep di ballot boxes and oda materials bin catch fire.

Di fire don scata di electoral materials and all di ballot boxes wia fit serve as reference for some of di vote tally for some polling stations.

Normally afta di electoral officer supervise di counting and collation of di vote, dem dey record di figures on top one result sheet (pink sheet).

Di sheet gat carbon copies na so dem go give one to di agents of di candidates wey bin stand for dat election.

Dis agents go sign on top di result sheet if dem all gree say di results be verified

For di case wia di electoral commission no get dia own original copy of di tally sheet, dem fit rely for di carbon copies from di agents.

But for dis instance, di goment party NDC say dem gat dia carbon copies of di results wia di NPP bin submit scanned documents, wia di NDC don reject.

Di NDC tok say dem no fit verify di figures on top di NPP scanned documents, na so dem call for rerun of di vote.

Six months na long time for pipo of one constituency to dey without lawmaker sake of di kasala wey happun for there.

Governance pipo say dis kind tin no be good for di kontris democracy and image .

For 2020, di electoral commission prevent Santrokofi, Akpafu, Lolobi and Likpe (SALL) pipo from voting during di general elections.

As a result, di pipo of SALL neva get representative for parliament for 4 years.

Pipo carry di mata go di Supreme Court but till now di apex court neva finish di mata (5 years later).

President John Mahama during im campaign ahead of di 2024 elections describe di tin as "cardinal sin for di fourth Republic of Ghana."

Sabi pipo say di denial of di SALL pipo dia representation for parliament go go down in history as crime wia di electoral commission don commit against di pipo.

For di 2024 elections however di SALL pipo bin vote wia dem now gat representative for parliament.

All eyes go dey for dat Ablekuma north constituency for di rerun of di 19 polling centres.

Di polls go open by 7 AM (GMT) wey pipo wia gat vote for dat constituency gatz to cast dia ballot to settle dis confusion once a for all.

Akua Afriyie or Ewurabena Aubyn? Na only time go tell

BBC News pidgin for bring Una all di update from dat election on Friday 11 July 2025.