BBC Pidgin of Monday, 28 July 2025

Source: BBC

Why US suspend visa processing for dia embassy for Niger Republic

Abdourahamane Tiani bi the president for Niger Abdourahamane Tiani bi the president for Niger

Di United States Embassy for Niamey, Niger Republic, don suspend all visa processing and issuance until further notice.

Tori by Reuters say a one internal memo from Washington on July 25 direct di embassy officials to stop all visa process until di US govment finish addressing dia "concerns wit di govment of Niger".

Di directive go affect all immigrant and non-immigrant visa categories, but most diplomatic and official visas no go dey affected, according to one tok-tok pesin for US State Department.

Dem no give any specific reason for dis move, but di State Department tok-tok pesin say "the Trump Administration dey focused on protecting our nation and our citizens by upholding di highest standards of national security and public safety thru our visa process".

Remember say in June dis year President Donald Trump bin don ban 12 kontris, including seven for Africa, from entering di US, and also restrict visa from seven odas.

Di African kontris for di list na: Chad, Republic of the Congo, Equatorial Guinea, Eritrea, Libya, Somalia and Sudan. While Burundi, Sierra Leone and Togo dey for di partial travel restriction list. Niger Republic no follow for any of dem.

However, e clear say di relationship between di two kontris no dey smooth, especially since di military bin take ova power for Niger Republic in July 2023.

In April of 2024, di military junta ask di US goment to withdraw dia troops for dia kontri, and by September, Washington say di withdrawal of almost 1000 US soldiers wey bin dey di kontri don dey complete.

Sabi pipo say dis move don change di relations between di US and Niger well-well.

But apart from dat, President Trump since e come into power for di second time, don put in place very hard policies about immigration.

E order a nationwide campaign to arrest migrants who dey stay for di kontri illegally, and im Immigration and Customs Enforcement (ICE) operatives don conduct dozens of raids to catch and deport pipo.

Even legal immigrants like pipo wit student visas and green card holders still fit chop deport if officials determine say dey support Palestinians or dey criticise Israel for di war in Gaza.

Di Trump administration say such actions dey pro-Hamas and na threat to U.S. foreign policy.

Last week, tori bin break say about 8000 Cameroon citizens fit chop deportation from di US afta one court bin approve for di Trump administration to remove di Temporary Protected Status wey Cameroonians bin dey enjoy.

US Secretary of State Marco Rubio tell tori pipo for May dis year say di number of visas wey im office don revoke dey in di thousands.

Also di State Department under Rubio leadership don tight dia social media vetting for pipo wey dey apply for U.S visa.

One Nigerian woman carry cry go social media for June dis year afta authorities deport am from di US wen dem go thru her instagram messages.



Di relationship between Niger and di United States don sour since Abdourahamane Tiani take ova power for di kontri afta a coup in July 2023.