You are here: HomeAfricaBBC2023 11 17Article 1882940

BBC Pidgin of Friday, 17 November 2023

Source: BBC

Why Premier League deduct ogbonge 10 points from Everton

Di Premier League deduct 10 points from Everton Di Premier League deduct 10 points from Everton

Everton don chop immediate 10-point deduction afta dem find say dem breach di English Premier League profit and sustainability rules.

Dis na di biggest punishment wey don happun for sporting sanction since di history of di Premier League.

Dis deduction go leave Everton for di 19th position for di Premier League table.

Di club say dem dey "both shocked and disappointed" by dis kain "wholly disproportionate and unjust" ruling.

Everton say dem intend to appeal against di decision.

Di Premier League bin refer Everton go independent commission wey dem setup but dem no reveal di kain alleged breach wey dem sama di club.

Wetin happun?

Dis whole mata don start since March and di offence na since di 2021/2022 season.

Everton bin post financial losses for di fifth successive year for March afta dem report £44.7m deficit for 2021/2022 season.

According to Premier League, clubs dey permitted to lose £105m ova a three-year period and Everton admit say dem breach di profit and sustainability rules (PSR) for di season wey end for 2021/2022.

For October, afta a five-day hearing di commission find say Everton losses during dat period don amount to £124.5m and e favour Premier League.

Everton for dia statement for March 2023 wen di mata bin dey reach serious stage deny di wrongdoings and reveal say dem dey ready to defend dia stand.

"Di club strongly contest di allegation of non-compliance and togeda wit our independent team of experts dey very confident say we remain compliant wit all di financial rules and regulations.

"Di club don provide information to Premier League for several years for open and transparent manner and we dey conscious to act wit utmost good faith at all times," Everton tok for March 2023

Meanwhile, for March 2022 Everton announce loss of £120.9m for di 2020/2021 season.

E mean say dat kain loss for ova a period of three years go reach up to £372m and dat don pass three times di £105m wey Premier League rules bin permit.

Although di club bin blame Covid-19 as part of wetin cause di losses, but dem hold say di club remain for " a secure financial position".

Everton wey don dey di process of building dia new Bramley-Moore Dock stadium go dey affected wit dis new deduction

Everton fit escape relegation?

For Premier League history, na only two clubs don receive dat kain points deduction.

For di 1996-97 season, Middlesbrough chop deduction by three points sake of say dem fail to fulfil a fixture against Blackburn.

For 2010, Portsmouth chop dia own deduction of nine points afta dem go into administration.

Sadly, none of di clubs escape relegation dat time sake of di sanctions wey dem sama dem.

Dis point deduction go carry Everton go di bottom of di premier league table. Dem go dey 19th position wit Burnley wey get four points afta dem play 12 matches.

Everton bin end last season wit just two points above di relegation position.

Dis season, dem bin dey 14th position for di league table and eight points away clubs wey dey bottom of di table.

How di club go escape relegation go be di focus of di manager Sean Dyche.

Manchester City and Chelsea fit dey at risk of same sanction

For February 2023, Premier League sama Manchester City charges wit more dan 100 breaches of financial rules afta dem do a four-year investigation.

Di Treble winners Man City even chop charges before Everton but di case still dey go on.

Manchester City na di only club wey Premier League don sama for financial breaches, wen dem refer dem go independent commission wia dem find more dan 100 alleged rule breaches between 2009 and 2018.

Man City bin say dem dey "surprised" by di charges and e dey supported wit a "body of irrefutable evidence", but di mata neva get any sanction yet.

Meanwhile, Chelsea sef fit chop sanction from football authorities afta reports of payments wey dey connected to former owner of di club Roman Abramovich.

Chelsea chop fine of £8.6m from European football governing body Uefa for July sake of say dem "submit incomplete financial information" between 2012 and 2019. Di document na part of a settlement say dem break financial fair play rules- di kain rule wey Everton break.