You are here: HomeAfricaBBC2024 01 02Article 1906784

BBC Pidgin of Tuesday, 2 January 2024

Source: BBC

Why Nigerian goment suspend accreditation of degree certificates from Benin Republic and Togo

Nigeria and Benin teachers Nigeria and Benin teachers

Nigeria goment don suspend di evaluation and accreditation of Degree Certificates from Benin and Togo Republics.

Di Ministry of Education for Nigeria announce di suspension inside statement wey dem release on Tuesday 2 January, 2024.

Na di Acting Director Press and Public Relations, Mrs. Augustina Obilor-Duru sign di statement wia dem say di suspension dey necessary afta one investigative journalist torchlight how pipo dey allegedly get University degree certificates wey suppose take 4 years to get, but dem dey get am in six weeks from dis kontris.

“Di publication by di Daily Nigerian Newspaper on 30th December 2023 titled “UNDERCOVER: How DAILY NIGERIAN reporter bagged Cotonou varsity degree in 6 weeks, participated in NYSC scheme”.

Dis report confam di suspicions say some Nigerians dey use mago-mago means and methods to get a Degree wit di end objective of getting graduate job opportunities wey dem no qualify for. “ Dem tok.

Wen di suspension go start?

According to di Ministry of Education for Nigeria wey dey para well well say dis kain tin dey happun, dem say di suspension go start immediately from Tuesday 2 January, 2024

“Di Federal Ministry of Education wit effect from 2nd January 2024 go suspend evaluation and accreditation of degree certificates from Benin and Togo Republics depending on di outcome of one investigation wey go involve di Ministry of Foreign Affairs of Nigeria and di two kontris.

“Di ministries wey dey responsible for Education for di two kontris as well as di Department of State Security Services (DSSS), and di National Youths Service Corps (NYSC).”

Di Ministry tell di General Public to support dis efforts, show understanding and provide useful information wey go assist di Committee to find lasting solutions so dat dem go stop am make e no happun again.

Di Ministry say dem don start internal administrative process to determine di pipo wey get hand inside or otherwise, including dia staff and dem go apply Public Service Rules.

Nigeria goment say di issue of degree mills institutions, (institutions wey dey exist on paper or wey dey operate anyhow outside di control of regulators na global problem wey kontri dey battle wit.

Dem add say Nigeria goment don dey fight dis problem since, including illegal institutions wey dey abroad or at home wey dey take advantage of unsuspecting, innocent Nigerians and some desperate Nigerians wey dey deliberately patronize dem.

Dem explain say from time to time di Ministry and Ntional Universities Commission dey give warnings against dis mago-mago institutions and dem go continue to review dia strategy to plug any loopholes, processes and procedures and deal decisively wit any official wey dey do collabo wit dem

Pipo wey wan serve go dey affected?

Concerning pipo wey don already graduate from universities from dis kontris wey wan go Nationl Youth Service, dis suspension go ffect dem? Na di question BBC Pidgin ask tok-tok pesin for di Ministry of Education, Mr Benjamin Goong.

Im tell BBC Pidgin say "Di Ministry of Education get committee wey dey handle pipo wey don graduate wey wan do NYSC, di committee go chook-eye well well to check properly if dem get any requests for NYSC as dis ban don dey in place.

For pipo wey don already use dis type of mago-mago certificate get work, Mr Ben Gong tok say e dey for Nigerian law say anybody wey im employers find out say e use fake certificate get any work dem go sack am.

"Di law apply from for evriwia , weda you bring di certificate from abroad or or you get am for inside Nigeria so far as e dey fake, di law say you go lose your job.

Mr Ben Gong add say wetin Nigerian students dey do no correct as far as international studies dey concerned.

Im say " before any student apply for any foreign school dem suppose come di Ministry of Education to verify if di school dey authentic, if dem get accreditation, if dem dey do di courses dem wan study, but dem go apply, school finish, wait until time for NYSC before dem go come di Ministry". im tok

We go dey update dis tori.