Nigerians on social media dey divided over di decision of one popular food stuff seller Omolola Mensah wey dey popularly known as Auntie Esther wey reject medically advised blood transfusion sake of her faith.
Auntie Esther wey popular on X for her market runs wey she dey do for pipo bin enta di platform for late November to seek for donation sake of breast cancer and Nigerians donate about 30 million naira for her treatment.
For update wey she give Nigerians on X, di 38-year-old, wey be member of di Jehovah's Witnesses, say, "My organs inside fine fine. Doc say she want start chemotherapy but I go take di injection. I respect evri one opinion but I and my family choose di Injection and food wey go boost my blood.
"Doc accept my decision, and she say she go follow me but nah small small e go reach wen I go start di chemo. I go dey on treatment to boost di blood count and chemo go start. I appreciate evribodi. Tank you @Wizard10 and @the_beardedsina. I dey get beta. God bless."
Aunti Esther dey currently receive care for di Lakeshore Cancer Centre for Lagos, southwest Nigeria.
"Thanks to you all wey don dey supportive wit donation and care for Aunty Esther. Latest update be say she dey respond to care. Her blood levels dey dey optimized for di next phase of care.
"Dem offer am di option of blood transfusion bifor she fit begin chemo, but she decline due to her faith. She be Jehovah's witness and thus, opting for oda alternatives. Though e go take longer and cost more, we gatz respect her religious belief.
"Di medical team get diagnosis now, wey dey currently guide her line of care. All funds go dey channelled towards her medical bills and hospital care. Once again, tank you for your kindness," Sir Dickson tok. Sir Dickson na one of di few Nigerians wey dey coordinate di donation.
Auntie Esther decision to reject blood transfusion make some Nigerians vex as dem want di pipo wey dey in charge of di money to redirect di funds to anoda patient wey dey willing to undergo full treatment, while odas believe say her religion gatz dey respected.
Why Jehovah's Witnesses no dey do blood transfusion?
Jehovah's Witnesses for dia website say dem dey seek best possible medical care for demsefs and dia families.
"Wen we get health problems, we go to doctors wey get skill in providing medical and surgical care witout blood. We appreciate advancements wey dem don make for di medical field.
"In fact, bloodless treatments wey dey developed to help Witness patients na somtin wey dem dey use now to benefit all for di community. For many kontris, any patient fit now choose to avoid blood-transfusion risks, such as blood-borne diseases, immune-system reactions, and human errors," Jehovah's Witnesses tok.
Di Church say dem no dey practice faith healing.
According to Jehovah's Witnesses, not accepting blood transfusion na religious issue rather dan medical one.
"Both di Old and New Testaments clearly command us to abstain from blood. (Genesis 9:4; Leviticus 17:10; Deuteronomy 12:23; Acts 15:28, 29) Also, God view blood as representing life. (Leviticus 17:14) So we avoid taking blood no be only in obedience to God but also out of respect for am as di Giver of life," di Church tok.
Genesis 9:4
But you must not eat meat wey still get im lifeblood.
Leviticus 17:10
I will set my face against any Israelite or any foreigner residing among them who eats blood, and I will cut them off from the people.
Deuteronomy 12:23
But be sure you do not eat the blood, because the blood is the life, and you must not eat the life with the meat.
Acts 15:28, 29
E seem good to di Holy Spirit and to us not to burden you wit anything beyond di following requirements: You gatz abstain from food wey dem sacrifice to idols, from blood, from di meat of strangled animals and from sexual immorality. You go do well to avoid dis tins. Farewell.











