Defence chiefs for di 54 African kontris dey meet for Abuja to chook mouth for security mata for di continent from 25 - 27 August 2025.
Di meeting wey go happun for di Bola Ahmed Tinubu International conference center, dey expected to begin talks on di strategies and response to security issues.
E dey expected to develop partnerships wit di private sector to deal wit di security needs for kontris.
Di summit dey under under di theme "combating contemporary threats to regional and security for Africa; di role of strategic defence collaboration."
For 12 March dis year, Ecowas Defence chiefs bin meet for Abuja to find ways to activate di standby force to deal wit terror threats for di Sahel region.
Di threat for di subregion and di continent at large don dey concern leaders, na so dem bin dey meet to find ways to deal wit am.
Insurgency attacks don dey rise for some parts of di continent according to di 2024 global terrorism index.
Di report tok say di Sahel don become di epicenter for terrorist activities wey dey account for 51% of all deaths from terrorism for dat year 2024.
Months afta dat conference, all Defence chiefs for Africa dey expected to meet for dis summit.
Nigeria chief of Defence staff General Christopher Musa tok say dis summit dey very necessary sake of insurgents no dey respect territories, dem just dey carry out dia activities for kontris.
"We gat to work as a team, as neighbours to deal wit dis threats. Dis summit go develop strategy wey go fit help us; na win-win for all of us," di defence chief tok for 13 August press conference.
Im add say "e dey important to come togeda to understand each oda, sake of we get regional blocs, wey each bloc get security activities within dia region, so we go fit sabi dia challenges and wetin dey work for dem, so say we fit share dis ideas."











