Nigerian President Bola Tinubu don sack di chairman of di board of Nigerian National Petroleum Company Limited, (NNPCL) board Chief Pius Akinyuelure and di group CEO Mallam Mele Kyari plus di oda board members wey im appoint for November 2023.
E replace di team wit Engineer Bashir Bayo Ojulari as group CEO and Ahmadu Musa Kida as non-executive chairman as dia appointment dey start immediately.
For statement wey di State House release on Wednesday, President Tinubu dey expect say di new board go increase NNPC share of crude oil refining output to 200,000 barrels by 2027 and 500,000 barrels by 2030.
E say di board restructuring bin dey important to ginger operational efficiency, restoreinvestor confidence, boost local content, drive economic growth and advance gas commercialisation and diversification.
Di oda members of di new board include: Adedapo Segun wey bin dey work as chief financial officer since November.
E also appoint non-executive directors wey go represent di kontri geopolitical zone. Dem include: Bello Rabiu for North West, Yusuf Usman for North East, Babs Omotowa for North Central, Austin Avuru for South-South, David Ige for South Wesr and Henry Obih for South East.
Oda members for di new board na di permanent secretary of di Federal Ministry of Finance, Mrs Lydia Shehu Jafiya wey go represent di ministry for di board and Aminu Said Ahmed wey go represent di Ministry of Petroleum Resources for di board.
Who be Engineer Bashir Bayo Ojulari?
Bayo Ojulari wey be di new NNPC Limited Group CEO come from Kwara State.
E graduate for from di Ahmadu Bello University, Zaria wit degree for Mehanical Engineering.
E bin work as di first Nigerian process engineer for Elf Aquitaine bifor e join Shell Petroleum Development Company of Nigeria Ltd in 1991 as associate production technologist.
Oga Ojulari don work for Europe and di Middle East as petroleum process and production engineer, strategic planner, field developer, and asset manager.
For 2015, e get work as di managing director of Shell Nigeria Exploration and Production Company (SNEPCO).
E bicom di charman and member of di board of trustees of di Society of Petroleum Engineers (SPE Nigerian Council) and fellow for di Nigerian Society of Engineers.
Bifor dis new appointment, e bin dey work as di Executive Vice President and Chief Operating Officer of Renaissance Africa Energy Company.
Who be di new Board Chairman, Ahmadu Musa Kida?
Ahmadu Musa Kida graduate for 1984 wit degree in civil engineering from di Ahmadu Bello University, Zaria.
E also get postgraduate diploma from di Institute Francaise du Petrol (IFP) for Paris in petroleum engineering.
E start im career for di oil industry of di Elf Petroleum Nigeria and for 1985, e join Total Exploration and Production as trainee engineer.
For 2015, oga Kida become di Deputy Managing Director of Deep Water Services for Total Nigeria.
For 2024, e become di Independent Non-Executive Director for Pan Ocean-Newcross Group.
Apart from im career for di oil industry, oga Kida na former basketballer and e bin be di president of di Nigerian Basketball Federation(NBBF) board











