BBC Pidgin of Thursday, 21 May 2026

Source: BBC

Who be ex-Cuba leader Raúl Castro wey US charge wit murder

Di US don charge former Cuban leader Raúl Castro wit conspiracy to kpai US nationals Di US don charge former Cuban leader Raúl Castro wit conspiracy to kpai US nationals

Di US don charge former Cuban leader Raúl Castro wit conspiracy to kpai US nationals and oda crimes ova di 1996 downing of two planes between Cuba and Florida.

Di case wey dem unveil on Wednesday accuse Castro and five odas for di shooting down of di aircraft wey belong to Cuban-American group Brothers to di Rescue and killing four pipo, including three Americans.

Den, Castro wey now be 94 na head of di kontri armed forces and bin face international condemnation ova di crash.

As di US seek to exert increasing pressure on Cuba communist rule, President Miguel Díaz-Canel call di charges "a political manoeuvre, devoid of any legal foundation".

Speaking at Freedom Tower for Miami, Acting Attorney General Todd Blanche announce say di US go also charge Castro wit destruction of aircraft, and four individual counts of murder ova di deaths of Armando Alejandre Jr, Carlos Alberto Costa, Mario Manuel de la Peña, and Pablo Morales.
Blanche say di United States and President Trump no go forget dia citizens.

Di charges gatz dey argued for US court, and some carry di life terms. Di murder charges each carry maximum penalty of death or life imprisonment.

Di justice department new charges take aim at key figurehead of Cuba communist leadership wen e dey face intense US pressure to make significant political and economic reforms to im one-party rule dia.

"I tink di strategy na to increase di pressure gradually to di point wia di Cuban govment go give in and surrender at di bargaining table," expert on Latin American politics for American University, Wiliam LeoGrand, tok.

Who be Raúl Castro

Raul Castro become Cuba leader wen im elder brother, Fidel, step down for 2006 to undergo intestinal surgery.

For 18 months, Raul presidency bin dey considered temporary, but im bin dey officially elected as president for 2008 wen Fidel bin decide to withdraw from office permanently.

For February 2013 Raúl bin dey elected by di National Assenbly to a second five-year term, but e say e go be im last.

Pipo see am as pesin wey no get di stature of im brother wey bin dey famous for im long, rousing speeches and defiance of di West.

However, Raúl bin hold plenti key positions bifor e become president, including di head of di Communist Party and di senior official for di armed forces.

Once elected president, e quickly introduce some small, but significant changes.

Cubans bin widely celebrate early move to relax restrictions on owning mobile phones and computers and rise in salaries and state pensions

Raul bin also allow unused state-owned land to pass ova to private farmers and cooperatives in attempt to boost domestic food production.