You are here: HomeAfricaBBC2023 11 07Article 1876637

BBC Pidgin of Tuesday, 7 November 2023

Source: BBC

Who be di Irish chef wey dethrone Hilda Baci for GWR longest cooking marathon

Alan Fisher of Ireland and Hilda Baci of Nigeria Alan Fisher of Ireland and Hilda Baci of Nigeria

One chef for one Japan restaurant Alan Fisher (Ireland), don break two cooking-related Guinness World Records titles, GWR tok.

First, e bin claim di longest cooking marathon (individual) afta e clock in time of 119 hours 57 minutes. Dat na more dan 24 hours longer dan di previous record wey Nigerian chef Hilda Baci hold.

Bifor dis cooking marathon, Alan bin claim di longest baking marathon (individual), wit time of 47 hours 21 minutes. Di previous record holder be Wendy Sandner (USA) wit time of 31 hours 16 minutes.

According to GWR, wetin dey more impressive be say Alan take both attempts back to back, e mean say e bin dey work for di kitchen for over 160 hours wit just over one day of rest in between.

Recreating Irish culture for Japan

Guinness World Records tell di tori of how di new record holder Alan bin try look for wetin to challenge am di year of im graduation from Dublin City University for 2008.

Den e bin go through one overseas graduate programme, wey dey introduce Irish graduates to companies for Asia, Alan den gbab one job offer for one company for Tokyo.

About six years later, Alan don establish imself wella for Tokyo, and also meet im wife (and to-be business partner). But sometin no feel right for am.

"After di wedding, to say bye-bye to 30 friends and family wey bin come over, I remember one feeling trapped, thinking to myself, 'Na dis be am? Dis na my life now, to get kids and work for di same company?' Na time for di next challenge."

So for August 2014, Alan bin take di leap of faith and decide to start im own business; e no dey difficult for am to pick Irish food and culture as di main themes of di business.

Alan restaurant Kyojin Stewhouse focuse on di mainstays of Irish households: stews, soups, homemade breads, and potatoes. According to Alan, customers no dey only feel like dem dey Ireland, but also feel as if dem dey dia home.

Breaking records

Alan bin hear about di longest cooking marathon record for March while e bin dey participate for di "I Love Ireland" festival for Tokyo. During dis festival, Alan bin stand inside one rented kitchen car and stay overnight twice.

During one break, e bin search on di internet to find out say di record for di time bin hold for Lata Tondon (India) wit time of 87 hours 45 minutes. Den for May, Alan realize say Hilda Baci don extend di record to 93 hours and 11 minutes.

Meanwhile, Alan still dey try recover from di difficulties during di COVID-19 pandemic.