BBC Pidgin of Wednesday, 16 April 2025

Source: BBC

Who be di House of Reps members wey go begin do Rivers House of Assembly work

Di National Assembly don inaugurate adhoc - committee Di National Assembly don inaugurate adhoc - committee

Di National Assembly don inaugurate adhoc - committee wey go make laws in place of di suspended Rivers State House of Assembly members.

Speaker of di House of Representatives, Tajudeen Abbas, inaugurate di 21 member committee for di National Assembly for Abuja on Tuesday.

During di inauguration of di 21-man committee, Speaker, Tajudeen Abbas tell di panel say dia mandate na to dey non-partisan.

Im add say na a call to make laws wey go ensure good governance, bring peace, and prosperity for Rivers State.

Im tok say "Your task na to oversee Rivers State following Mr President emergency proclamation. You no suppose dey partisan or bias."

Who be di members of dis committee

Di House of Representatives for inside statement bin list di names of members of dis committee.

Tok-tok pesin for di House, Akin Rotimi, for di statement bin tok say na sake of di presidential proclamation wey dem bring come di dormot of National Assembly, na why dem duly subject am to serious legislative consideration.

Dem bin also amend am to strengthen democratic safeguards and to uphold di principles of checks and balances.

"One of di most consequential amendments na di designation of di National Assembly – instead of di Federal Executive Council – to be di oversight authority for all regulations dem issue under di emergency arrangement.

"In line wit Section 5 of di State of Emergency (Rivers State) Proclamation, 2025, and pursuant to Section 11(4) of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, di House don constitute a dedicated ad-hoc committee to monitor implementation and to make sure say governance for state remain witin di bounds of constitutionalism and rule of law," part of di statement tok.

According to di statement, members of di House of Reps wey make up di adhoc committee na:

House leader, Prof Julius Ihonvbere na di chairman while minority Whip, Isa Ali go act as di Deputy Chairman.

Other members of di committee na Isiaka Ibrahim, Idris Wase, Muktar Betara, and Sada Soli. Abiodun Faleke, Amos Daniel, Erhiatake Ibori-Suenu and Blessing Onuh.

Iduma Igariwey, Shehu Rijau, Oluwole Oke, Etinosa Amadi, Patrick Umoh. James Barka, Alex Egbona, Isa Anka and Fatima Talba.

Even though many sabi pipo bin condemn di declaration of State of Emergency wey President Bola Tinubu declare for Rivers State, di national assembly ratify di emergency rule.

Dem agree say President Bola Tinubu do di right tin for di interest of public peace and order.