One lawmaker for Ghana wey im name be Ernest Kumi don die afta im sick, im party confam.
Di lawmaker of di opposition new patriotic party (NPP) dey represent di pipo of Akwatia for di Eastern region for parliament bifor im die.
On Friday im appear on top local media networks for discussion on top morning shows.
Di Eastern region branch of di NPP for one statement confam di death wia dem tok say "na heart-breaking news wey don shock di party."
"We dey sad about dis news, di pipo of Akwatia and di NPP shock," oga Evans Osei Yeboah wey bin sign di statement tok.
Di party for di region add say "Honourable Kumi na dedicated public servant wey dey committed to di development of Akwatia."
"We extend our condolence to im immediate family , di chiefs and pipo of Akwatia constituency and di entire NPP across di kontri," di Eastern region tok tok pesin oga Evans Osei Yeboah bin write.
Im death don shock pipo as di 40-year-old bin dey parliament on Friday for im work bifor di house adjourn sitting dat day.
Na first time member of parliament wey win di controversial seat during di 2024 elections.
Controversy bin dey about im parliamentary seat
Oga Ernest Kumi bin win di 2024 parliamentary elections for di constituency but opposition party at dat time, di national democratic congress (NDC) tok say dem bin tiff dat election, allegedly.
Di NDC tok day irregularities like vote-buying and rigging bin happun for di elections.
Di electoral commission declare di results as Ernest Kumi - 19,269 votes wey im opponent , di NDC candidate oga Boakye Yiadom bin get 17,206 votes.
But di NDC candidate bin challenge di results for di Koforidua high court wia dem file injunction say make dem no swear oga Ernest Kumi in as MP on January 6, 2025.
Na so di court gree wia dem tok say make oga Kumi no hold imserf as MP for di area unless dem determine di substantive case.
But during di swearing in ceremony for di new MPs on di night of 6 January 2025, oga Ernest Kumi don enta parliament for di swearing-in.
Even tho di clerk bin read one statement on di floor of di house say dem receive court documents say make dem no swear am in, oga Ernest Kumi still dey di chamber wey im recite di oath of office as MP.
Na so di high court for Koforidua bin cite oga Ernest Kumi for contempt of court.
Throughout di contempt proceedings oga Kumi no attend di sittings, na so di court now issue bench warrant to arrest am.
Later, im party di NPP bin write to di court say im no dey available for di court sittings sake of im gatz parliamentary duties, but di court bin reject dat excuse.
Lawyers for di MP now enta Supreme Court to challenge di contempt conviction wia dem win.
Di Supreme Court for majority 4-1 decision bin quash di contempt conviction of di high court for Koforidua.
But di Supreme Court no gree to dismiss di opposition NDC election petition against di results for dat constitution.
Di substantive petition case still bin dey bifor di Koforidua high court bifor oga Ernest Kumi don die on 7 July 2025.
"Wit dis development, as im don die, di legal matter wia be di election petition wia im dey involved, don end," one private legal practitioner Denis Pwaberi Wedam don tok di BBC.
Wetin go happun next
For di Ghana electoral laws, if lawmaker die while im dey for parliament, dem gatz to hold bye-election for di constituency.
Di party wia di decreased pesin dey represent, go president anoda candidate for dat by-election.
Until 2020, four wives of MPs wey die while dem dey parliament don succeed dia husbands.
Madama Akanvariba Lydia Lamisi bin enta parliament to succeed her husband David Adakudugu wia bin die on 20 September 2019 afta im fall sick.
Since dem she bin win di subsequent elections for 2020 and 2024 to remain for parliament as di MP for Tempane constituency.
She dey appointed by President John Mahama now, as minister of state for Public sector reforms.
Bifor her, madam Linda Ocloo wia be wife of MP for Shai Osudoku constituency (Desmond William Ocloo) don succeed her husband afta im die for car crash in March 2016.
She don win di 2020 and 2024 elections wia she di current president don appoint her as minister for di Greater Accra region.
Anoda wife of MP wey die, Lydia Alhassan, don succeed her husband Kyerematen Agyarko wey die as im be MP for Ayawaso West Wuogon constituency.
Madam Lydia bin serve di remaining term of office for her husband from 2018 to 2020 bifor she stand elections for 2020 to win di elections for dat constituency.
Later for di former government of Nana Akuffo-Addo, dem appoint her minister for sanitation.
But for di 2024 elections she bin lose to actor John Dumelo wey don dey represent di pipo of Ayawaso West Wuogon constituency.
Di oda woman wey succeed her late husband for parliament na madam Ophelia Hayford wey be police officer.
Her husband been die for one robbery aattack when im dey return from campaign.
Di NPP now nominate her to replace her late husband for di 2020 elections wia she win am.
She bin dey represent di pipo of Mfamtsiman for di central region since den; she also win di 2024 elections to remain for parliament.
E no dey clear at dis stage whether im wife go dey interested to succeed her late husband as MP for di Akwatia constituency.
If she gree to inherit di seat by her husband, di party (NPP) go nominate her to contest for di by-election wit oda parties.
If she win, den she go represent di pipo of Akwatia for parliament but if di party decide to select anoda candidate for di by-election, na dat pesin go be di MP for di area if im win di by-election.
Profile of di late Ernest Kumi
Ernest Kumi bin comot Akim Wenchi, wia dem born am for Wednesday 5 December 1984.
Im be Christian wey dis na di first time im dey represent di pipo of Akwatia for parliament.
Bifor im become politician wey win di parliamentary elections, im bin dey work as senior manager - securities and administration for American Tower corporation, according to official informate from di Ghana parliament.
Bifor im death, im bin member on top di lands and natural resources committee for parliament.
Di late MP Ernest Kumi gat LLB law degree from Mountcrest University college and MBA for corporate governance from di university of professional studies (UPSA).

One high court bin convict am for contempt afta im defy injunction for 6 january 2025 swearing in ceremony but im fight di conviction for supreme court wia im win











