BBC Pidgin of Wednesday, 28 January 2026
Source: BBC
US President Donald Trump don deploy im border oga kpatakpata, Tom Homan, to lead immigration enforcement for Minneapolis, afta federal agents bin shoot two US citizens die for di city in less dan one month.
Di White House tok say Homan, who bin arrive for Minneapolis on Tuesday, go now be di "main point of contact on di ground" and e go meet wit city officials.
Dis dey come as Gregory Bovino, who be di US border patrol oga and public face of di Trump administration mass deportation drive for cities across di US, dey expected to leave di city along wit some of im agents.
Pipo dey see di 64-year Homan as key Trump ally and pesin wey get plenty experience for immigration mata across both Republican and Democratic administrations.
Im na also one of di most vocal defenders of Trump immigration policy and mass deportation drive.
A native of upstate New York, Homan start im career for law enforcement as a police officer bifor e join border patrol in 1984 for southern California.
Four years later, e join di Immigration and Naturalization Service as dem dey call am dat time, and e climb through di ranks ova di years.
By 2013 - during di Obama administration - e bin hold one important post as di head of di Enforcement and Removal Operations arm of Immigration and Customs Enforcement (Ice)
Homan bin don plan to retire for 2017, just days bifor Trump first administration start, but di incoming Chief of Staff John Kelly call am as e dey celebrate im retirement party, and dat call change im plans.
"I remember as e tell me say, I know say dis na bad timing, but di president-elect want me to stay and run [ICE]," Homan tok for one interview last year wit di Daily Caller. "Monday morning, I call [Kelly] and tell am say I wan come bak."
Anoda call from current Chief of Staff Susie Wiles, again bring am out retirement for 2024 ahead of di second administration.
While di title "border tsar" na informal term and position, e refer to di executive-branch role wey dey oversee border and immigration policy across multiple agencies. E no need Senate confirmation, and na policy position wey be say na di serving president dey appoint am directly.
So far for Trump second term, Homan na vocal defender of di president deportation goals, and e don vow to target di "worst of di worst" and to challenge di notion say "dose wey dey enforce di law na di bad guys and dose wey dey break di law na di victims".
But true-true, as dem dey enforce immigration laws and attempting to focus on public safety threats, di net don also catch oda undocumented migrants wey no get any criminal background.
Homan acknowledge dis fact but e blame am on "sanctuary cities" wey no dey work wit federal immigration efforts. Officials tok say di act of being in di US illegally na crime on im own.
"We no go instruct ICE say make dem no arrest pesin unless e commit a serious crime," Homan tell tori pipo in July for di White house wia e dey appear regularly.
"Wetin be di message e go send to di whole world? Go ahead and enta di kontri," Homan added.
For September, di White House kiakia defend Homan afta dem accuse am for one bribery magta wey di justice department later drop.
White House Press Secretary Karoline Leavitt describe dat case - wey accuse Homan say e bin accept $50,000 from undercover agents - as effort to "entrap" ogbonge Trump ally.

