Ozzy Osbourne, na one of di most recognisable and ogbonge musicians for rock, e die at di age of 76.
As frontman of Black Sabbath, di Birmingham-born musician na one of di musician wey pipo say invent heavy metal, tanks to songs like Iron Man and Paranoid.
Less dan three weeks ago, di self-styled "Prince of Darkness" bin perform for im farewell concert for im hometown, many musicians wey im bin inspire support am for di concert, dem include Metallica and Guns n' Roses.
For inside one statement, im family say: "We no fit tok how sad we dey to report say our beloved Ozzy Osbourne die dis morning. Im bin dey wit im family and surrounded by love."
Dem no tok di cause of im death, although di star get a series of health problems and doctors bin diagnose am wit Parkinson for 2019.
Tok-tok pesin for di family confiam to BBC News say Osbourne die for UK.
Ozzy Osbourne profile
My full name is John Michael Osbourne. I dropped out of school at the age of 15, and I did several low-paid jobs and spent a short time in prison for burglary before I started my musical career.
Afta e sing wit several local bands, e join Black Sabbath wit guitarist Tony Iommi, bassist Geezer Butler, and drummer Bill Ward for di late 1960s.
Dem develop one unique sound, wey dey inspired by blues but slower, louder and one kain sound - wit frequent references to occult.
Many pipo consider dem as pioneers of heavy metal, dem release dia self-titled album for 1970 and follow am up wit platinum records like Paranoid and Master of Reality throughout di rest of di decade.
Afta dem fire am from di band in 1978, e launch a successful solo career wit di 1980 album Blizzard of Ozz, featuring di classic single Crazy Train.
Di following year, Diary of a Madman bin dey even more popular, e sell more dan five million copies.
Along di way, Osbourne build a reputation for im crazy live performances, wit (possibly exaggerated) story say im bin once bite di head comot of one live bat by mistake during one of im concert, tinkin say na toy wey fan throw give am for stage.
Im use of drugs and drinking no be small, e lead to some peculiar behaviour. Di rock band Motley Crue bin once describe how Osbourne, for competition to see which pesin habits bad di most, snort a line of ants from one hotel floor.
Also im addiction bin get dark side. For 1989, im wake up for jail, afta authorities arrest am for di attempted murder of im second wife, Sharon.
Following dat arrest, court order Osbourne to spend six months for rehabilitation. sake of say im show remorse, Sharon decide not to press charges.
She tok for di 2020 documentary Di Nine Lives of Ozzy Osbourne, she say: "I tell am, 'I no want di money but if you do dis again, either na me go kill you or you go kill me. You want dat kain tin for di kids?'"
For di 1990s, im transform im wild image thanks to di MTV reality show di Osbournes - wey show di star as di well-meaning, patriarch of one unruly household.
Dis, im say, na im true personality.
"All di stuff onstage, di craziness, na just role wey I need to play, for my work," Im bin tell Di New York Times for 1992. "I no be Antichrist. I be family man."
Di Osbournes also make im wife Sharon wey be im manager star, and children Jack and Kelly stars too - wey im do duet wit for im chart topping version of di Sabbath song Changes for 2003.
Na di same year, however, wey im bin suffer from one spinal injury for 2003 afta car crash wey bin involve an all-terrain vehicle, or ATV.
Di injury bin worse sake of one late-night fall for 2019, wey bin require several rounds of extensive surgery.
For 2020, di star reveal say doctors diagnose am wit Parkinson wey largely make am step back from touring afta im bin play for di closing ceremony of di Commonwealth Games for 2022.
However, im bin dey determined to make one last appearance, bowing out wit im last concert for Birmingham Villa Park on 5 July - a stone throw from im childhood home for Aston.
Di musician sing while im bin siddon for one black throne - e clap, wave im arms and do im wild-eyed looks as e perform im hits including Crazy Train, Mr Crowley and War Pigs.
Im bin dey overwhelmed at some moments. "Una no get idea how I dey feel. Thank you from di bottom of my heart," Im bin tell di audience - and almost six million more pipo wey bin tune in for di live stream.
Speaking on stage, Pantera frontman Phil Anselmo say di artists on di bill "go be different pipo" without Osbourne and Black Sabbath.
"Dat na di truth. I for no dey up hia with dis microphone for my hand without Black Sabbath. Di greatest of all time."
'A true rock legend'
A host of stars including Rolling Stones' Ronnie Wood and Metallica bin pay tribute to Osbourne.
For social media, Black Sabbath co-founder Tony Iommi say im no fit "really find di words" im add say im and di oda band members don "lose dia brother".
Fellow band member, bassist Terence "Geezer" Butler, say "Goodbye dear friend - thanks for all those years - we get some great fun. Four kids from Aston - who for reason am, eh?"
Elton John say Osbourne na "a dear friend and ogbonge trailblazer wey don secure im place for pantheon of rock gods - na true legend".
Singer Yungblud, wey bin perform a cover of Changes for di farewell concert wit Black Sabbath for Birmingham just weeks ago, hail Osbourne as a "legend" and say "I bin no think say you go leave us so soon".
Queen guitarist Sir Brian May say "di world go miss Ozzie unique presence and fearless talent", im add say im dey grateful to share "a few quiet words wit am" afta Osbourne final show.
Green Day singer Billie Joe Armstrong post one photo of di singer on Instagram and write: "No words. We love you Ozzy."
Sir Rod Stewart say: "Bye, bye Ozzy. Sleep well, my friend. I go see you up dia - later rather dan sooner."
Henry Rollins, former frontman of Black Flag, say e dey "rare say somebody go dey so synonymous" wit a musical genre.
"But if you wan tok about heavy metal, first up na Ozzy Osbourne and Black Sabbath. Everybody else go come afta."
Former Van Halen frontman Sammy Hagar, wey dey among musicians wey perform during Black Sabbath final show, say Osbourne "go always be one of a kind, true rock legend".
Osbourne leave behind im wife and dia three children, Aimee, Kelly and Jack Osbourne, and several grandchildren. Im also get three children from a previous marriage: Jessica, Louis and Elliot.












