BBC Pidgin of Friday, 19 September 2025

Source: BBC

Who be Jimmy Kimmel and wetin e tok about Charlie Kirk wey make dem suspend am?

TV host Jimmy Kimmel chop indefinite suspension afta dem pull am off air TV host Jimmy Kimmel chop indefinite suspension afta dem pull am off air

TV host Jimmy Kimmel chop indefinite suspension afta dem pull am off air sake of im comments wey e make about di shooting of Conservative activist Charlie Kirk.

Di comment wey Kimmel make bin cause im suspension afta plenti pipo including US President Donald Trump bin also react to di mata.

Wen Kimmel make di comments on im late-night show about di death of conservative activist Kirk wey die through gunshot, e cause reactions from commentators and broadcasters wia some say e dey right say Kimmel face di consequences of wetin e tok.

Kirk wey be influential ally of di US president die afta dem shoot am for one campus event for Utah on Wednesday, 10 September 2025.

Di shooting of Kirk cause serious tok tok for di US and many dey concerned as to who be di shooter and why di pesin carry out dat kain tin.

Wetin Jimmy Kimmel tok?

Trump bin order say make dem fly flags for half-mast for US to honour di conservative activist.

E no tey wey di Federal Bureau of Investigation (FBI) release fotos of one "person of interest" for di shooting of Charlie Kirk, and dem later identify am as 22-year-old Tyler Robinson.

Howeva, during im night show, Kimmel speak about di flags wey dey fly at half mast in honour of Kirk wia e mock US President Trump reaction to di shooting.

For im monologue for di show, di US Tv host Kimmel bin suggest for im tok say di shooter of Kirk na supporter of Trump and say di govment dey play politics wit di shooting.

Na from hia di suspension mata begin wen Federal Communications Commission (FCC) bin threaten to act against ABC, wey be di Tv wey Kimmel dey host im show.

E no too long, ABC say dem suspend comedian Kimmel afta im comment on di death of Kirk.

Wetin Jimmy Kimmel tok?

Kimmel dey among di top chat show personalities for di US, as e dey host im show Jimmy Kimmel Live! since 2003.

"Dis no be how adult dey grieve di murder of someone e call friend. Dis na how four-year-old mourn goldfish," dis na part of wetin Kimmel tok for im show.

Di one wey burst evriwia na im monologue wia e say dem dey use di killing of Kirk to 'score political points.'

Kimmel say: "Di Maga Gang dey desperately try to characterise dis kid wey murder Charlie Kirk as anytin oda dan one of dem and dey do evritin dem fit do to score political points from am."

"Maga" - na reference slogan to Trump supporters wey rally around im Make America Great Again election.

No be di first time wey Kimmel bin address di shooting of Kirk, e don earlier send 'love' to di family of Kirk, but dis comment wey e make for im show get di attention of plenti pipo.

Wen FCC threaten to act against ABC and dia parent company Disney ova di comment of Kimmel, dem add say di host dey try 'to directly mislead di American public".

FCC chairman, Brendan Carr say make Kimmel bin tender apology sake of dat im comment.

Na hours later, Nexstar Media, one of di biggest owners of TV stations for di US, say dem no go air Kimmel show afta dem label im comment as "offensive and insensitive for critical time".

Trump, oda react to Kimmel suspension

Di suspension of Kimmel come afta di threat from FCC, di govment agency wey dey regulate television and radio communications.

For Trump e say dem fire Kimmel sake of say "e get bad ratings".

US President also post for im Truth Social wia e clap hand for ABC for si suspension wey dem sama di Tv host."

Leading Democrats don blast di suspension decisions as assault on free speech.

Democratic Leader Hakeem Jeffries issue statement alongside oda senior leaders for di party, wia dem say di FCC chairman Carr bin "engage for corrupt abuse of power.".

"E don disgrace di office wey e hold by bullying ABC, di employer of Jimmy Kimmel, and force di company to bend di knee to diTrump".

Meanwhile, journalist and presenter Piers Morgan say Jimmy Kimmel bin lie about Charlie Kirk assassin say e be Maga.

Morgan say di statement cause serious kasala for America and dat don lead to im suspension.

Also, di largest ABC affiliate for di US dey ask make Kimmel to apologise and make donation to Charlie Kirk family and political organisation bifor im show fit go back on air.

Sinclair Broadcast Group, wey own many local ABC channels, na part of di two groups wey say dem go pull Jimmy Kimmel Live from dia channels bifor ABC come suspend di show.

Di Writers Guild of America (WGA) and di Screen Actors Guild–American Federation of Television and Radio Artists (SAG-Aftra) stand wit Kimmel afta dem suspend im show.

"Di right to speak our minds and to disagree wit each oda dey di veri heart of wetin e mena to be free pipo", di Writers Guild tok for dia statement.

Also, more Tv host don stand behind Jimmy Kimmel.