Di constitution amendment bills by di Nigeria National Assembly don hold national public hearing for di Constitution Alteration Bills wia about 86 bills dey ground to review.
House of Representatives Committee on Constitution review gada wit different stakeholders to tender dia view on di part wey dem wan review for di Nigerian Constitution.
According to di Deputy Speaker of di Nigeria House of Representatives, Benjamin Kalu, e say di national public hearing on di Constitution Alteration Bills wey hold for Abuja on 22 September na ways to show say di Nigeria Constitution belong to evri Nigerian.
Dis public hearing dey come afta zonal hearings wey di Senate and House of Representatives Committees on Constitution Review do across di six geopolitical zones, wey dem hold for July 2025.
Di input for di Constitution review come from different constituencies and groups wey include di Nigerian Governors Forum, women groups, traditional rulers, security sector, professional associations and civil society.
According to Policy and Legal Advocacy Centre (Plac) wey be part of di group wey dey lead di conversation for di Constitution review, dem deliberate on different proposals wey border on pressing issues wey Nigeria dey face.
Di issues wey di proposed bills include Security and policing reforms, establishing local govment election tribunals, Special Seats Bill for women, recognition of traditional institutions, Electoral reforms, Judicial reforms, amongst odas.
Howeva, di bill go still go through some oda stages bifor dem pass am into di Nigerian Constitution.
But make we look wetin dey inside di Constitution review according to dia category, di part wey dem wan touch and how e go take become constitutional.
List of di bills wey di National Assembly dey review
Electoral reforms
Dis one get twelve (12) Bills wey dey aim to address di conduct of all general elections for single day.
Di Bill dey seek to alter Sections 84, 153 and di 3rd Schedule of di Constitution to provide say all general elections for Nigeria hold held on the same day
E go also address issues of decamping as ground for impeachment, give room for independent candidature and also establish local govment elections commission- dis go alter provisions of Sections 7, 65, 106, 131,177, 221 and 228 of di Constitution.
For inside dis review, di bills dey aim to address di appointment of Chairman of di Independent National Electoral Commission by di National Judicial Council.
E also propose to address di conclusion of pre-election matters and petitions bifor swearing-in.
Judicial reforms
Under di one, e get twenty one (21) Bills wey dey proposed for amendments.
Bill under dis review dey seek to make di Court of Appeal as di final appellate body for some election petitions and to create local govment election tribunals.
E dey also seek di removal of di Chief Justice of Nigeria and Chief Judges of di States from di Federal and States Judicial Service Commissions, and also to increase di number of Justices of di Federal High Court, Supreme Court and Court of Appeal.
To increase membership of di Code of Conduct Tribunal, provide time-bound procedures for appointing new Justices of di Supreme Court and new acting heads of courts, involving di National Judicial Council for di fixing and increase of remuneration of judicial officers, also dey part of di review under di category.
Legislature reforms
Dis legislative reform get three (3) Bills under am wey dem propose di transfer of di power to proclaim new Assembly to di Clerk of di National Assembly or di House of Assembly, instead of di President or Govnor to dey carry out such power and duty.
E also propose timelines for di presentation of treaties to di National Assembly for enactment, to alter Section 12 of di Constitution to specify timeframe wey di executive gatz present any treaty wey dem enat into between Nigeria and any oda kontri.
Di review dey also present Bills wey go mandate automatic admission of National Assembly members wit valid Certificates of Return to enjoy rights and priviledges.
Inclusive governance
Dis review get three (3) Bills wey dey proposed to create reserved seats for women and physically challenged pesins for di National and State Houses of Assembly.
E also dey propose certain percentage for di numbers of Ministers of di Federation to be reserved for Women.
Security and Policing
Dis particular review get single bill wey propose di establishment of State Police and to make di independent Police Force for each State of di Federation.
Transfer of power
Di Bills on transfer of powers na ten (10) and e dey aim to transfer control of natural resources for state to dey jointly owned between di federal and State govment,
E dey also propose transfer of water management to State govments, transfer mines and minerals to State govments wey go dey remit 25 per cent of such revenue to di federal govment.
Dis proposals also include transfer and inclusion of taxes and levies, road tolls, transfer construction of non-trunk A roads to di concurrent legislative list, and allow States to fund and manage infrastructure.
Strengthening institutions
E get fourteen (14) Bills wey dey aim to expanding di federal civil service commission so e go get enof representation from all States.
Di bill go also mandate govment agencies to submit yearly financial statements to di Auditor-General, mandatory conduct of national population census once evri 10 years.
E dey also propose timeline for budgets to dey presented to di National Assembly and State Houses of Assembly.
Under dis one, e get amendment bill to separate di office of di Attorney-General from dat of di Minister/Commissioner of Justice, and proposal to give di National Assembly power to summon di President or State govnors to answer key national security issues.
Proposals wey also dey under dis category include bill to return to Parliamentary system of govment, and establishment of House of Assembly for di Federal Capital Territory.
Traditional institutions
Dis category get just one Bill wey dey seek to recognize and establish di advisory and functional roles of traditional rulers within di security and governance framework- e go alter Section 220 of di Constitution.
Fiscal reforms
Dis category get two (2) Bills wey dey focus on to mandate di publication of di Auditor General reports and to assign special account for money wey dem borrow and credit facilities.
Dis go alter sections 85, 80 and 125 of di Constitution.
Citizenship and Indigeneship
E get four (4) Bills under dis category wey dey propose new "citizenship by investment" for di kontri.
Di bills dey also proposed to grant citizenship rights to spouses of Nigerian women and granting indigene status to pesin by reason of birth, marriage or settlement for not less dan 10 years.
E go mean say dem go grant citizenship to men wey marry women from Nigeria- dis go alter provisions of sections 26, 26, 42 and 223 of di Constitution.
Fundamental human rights
Na four (4) Bills dey under dis review, and e dey seek to define torture and inhuman treatment to include parading of crime suspects.
Anoda Bill dey also propose to direct courts to automatically change death sentence on pregnant woman to life imprisonment, to help reinforce di right to life for unborn children of convicts.
E dey also propose say any International Human Right Instrument ratified by di federal govment go automatically gain di force of law for Nigeria wih no further need for legislative process.
Local govment autonomy
Under dis category, e get (14) Bills wey dey seek di autonomy of di local govments to provide structured system of executive and legislative arms of di local govments.
E dey also propose independent electoral body for conducting election to local govment offices, and full financial autonomy for local govment councils.
Part of di bill amendments dey also seek to rename and decide exact location of certain local govment areas for Oyo, Kaduna, Abia, and Ebonyi States.
How di review go enta Nigeria Constitution wen dem pass am
Afta di national public hearing, di Committees go put dia reports togeda and present dem to dia respective chambers.
Den, both Houses go come vote on di alteration bills by November, pass am to State houses of assembly for December for agreement, and dem go come pass am give di president for assent by January.
According to Plac, if dis timeline go as suggested, "e go mark one of di most fast and structured constitution review exercises since 1999."
Constitutional amendment for Nigeria require two-thirds support for di di National Assembly and den approval by at least 24 of di 36 State Houses of Assembly.











