BBC Pidgin of Thursday, 21 August 2025

Source: BBC

Which impact Eberechi Eze fit bring to Arsenal squad?

Eberechi Eze bin score di winner for Crystal Palace against Man City for di FA Cup final , May 2025 Eberechi Eze bin score di winner for Crystal Palace against Man City for di FA Cup final , May 2025

Di dramatic move wey Arsenal dey make to gbab Eberechi Eze from arch-rivals Tottenham Hotspur na big statement of how dem dey plan to show diasef dis season weda dem go finally win di biggest prize.

Spurs bin don ready to welcome di Crystal Palace and England forward on Wednesday, afta dem beliv say di deal for di 27-year-old don complete already.

Tori later come out say Arsenal bin dey chook eye to check di seriousness of di injury wey dia striker, Kai Havertz get.

Dis injury fit potentially stop di attacking resources - dis weakness bin play a significant part for manager Mikel Arteta side to end di season without any trophy for five years back to back.

Instead of dem to take di option of exploring di loan market wey dey cheaper, as pipo bin dey expect, Arsenal go all di way wit style as dem set up £60m coup to carry Eze go Emirates Stadium.

Arsenal do Spurs strong tin to snatch Eze deal

Di move of Eze to Arsenal na simple but devastating psychological blow wey di target dey aim north London and na Spurs.

Na clear signal say di Gunners no get plan to fall short for dia plan to mount serious Premier League title challenge, dem wan also plan to go far for di Champions League once more afta dem reach di semi-finals last season.

Na beta strategy wey be di opposite of dia pattern wey neva change for years.

Dis pattern bin also hold Arsenal last season, wen dem bin fail to solve di problems wey evribody dey see - by signing beta striker wey dey recognised - e cost dem dearly.

Spurs bin tink say dem Eze deal don complete, wit di possibility of cash-plus-Richarlison deal wey dem bin discuss, but Arsenal move with speed immediately dem see di possibility say Havertz fit face a spell on di sidelines wit injury.

Arsenal bin dey linked wit Eze all summer, but e be like say dia interest bin reduce afta Ethan Nwaneri agreed new five-year contract, on top of signing Chelsea winger Noni Madueke for £48.5m deal.

Havertz injury, and di potential consequences, ginger dia interest to shock Spurs.

Arsenal dey spend money to win big dis season

Arteta know say im must win any major trophy dis season, and to achieve am, ogbonge pipo for Arsenal leadership dey support am.

Even wit Madueke, di Gunners don conclude moves to sign one outstanding midfielder from Spain, Martin Zubimendi for deal wey worth up to £60m and, at least 12 months too late, dem get recognised striker, Viktor Gyokeres, from Sporting for £64m.

For Eze, wey bin get two years more for im Palace contract, Arsenal go get beta striker wey get rich and natural talent, wey be match-winner - as im bin prove wen e score di winner against Manchester City for di FA Cup final for May.

Dis na follow-up to di spectacular right-foot finish wey bin set Palace on dia way to di 3-0 win ova Aston Villa for di Wembley stadium semi-final.

Eze bin also score di Eagles' opener wen dem beat Fulham 3-0 for Craven Cottage for di quarter-final.

Eze don show say im get di temperament and talent for di big occasion wen e ginger Palace to dia first major trophy for dia history.

Arsenal go dey hope say im go get plenti of dat kain occasions in future.

Im be di scorer and creator wey go add real threat to Arsenal front line, wit 14 goals and 11 assists for all competitions last season.

Eze na Arsenal fan wen im be small boy and im na part of di club academy until im reach 13 years.

Even though im bin get interest to move to Spurs, once di Gunners show dia hand e sure for am say na only one part of north London im dey head to.

Im don achieve im goals di hard way, as im bin play for Fulham, Reading and Millwall bifor im sign for Queens Park Rangers.

Im comot from Loftus Road go join Palace for £19.5m deal for August 2020.

Spurs believe say dem bin do evritin to conclude im deal - apart from say dem bin no actually conclude am - but na hammer blow to chairman Daniel Levy and manager Thomas Frank, wey also tink say dem bin get a deal for Morgan Gibbs-White already, only for am to sign new contract for Nottingham Forest.

Arsenal will go continue to enjoy di local rivalry say dem snatch one of Tottenham prime targets, but di wider context show say di Gunners don serious well-well to end dia wait for success wey don stretch back to 2020.

Eze bin admit say im bin "crying for one week" wen Arsenal bin no sign am for 2011, but di beta striker don get a golden opportunity now to make up for di time im bin lose.

Wetin Eberechi Eze go bring to Arsenal

Some sports tok-tok pipo for Nigeria don chook mouth for dia Eberechi Eze move to Arsenal.

Abdulkadir Adedapo tell BBC News Pidgin say Eberechi Eze fit just be di player wey go lead Arsenal and Mikel Arteta to di Premier League title.

"Di Gunners sign player wey already get Premier League experience and im fit be threat to any defence for di league.

Eze go bring plenti creativity and sweet football to Arsenal dis season. Na di type of player wey fit open tight defence wit im dribbling, quick turns, and vision."

Im add say sometimes Arsenal dey struggles wen teams dey play defensive game deep and dem no go fit rely on Saka alone evritime so Eze fit carry di ball forward, beat players one-on-one, and create chances out of notin.

'Im go also add goals from midfield, wey go take pressure from di strikers. On top of dat, im sabi plenti tins wey mean say im fit play can play as attacking midfielder, winger, or even drop deep wen dem need am and dis fo give Arteta more options.

"Im arrival arrival fit just be di best coup for di Premier League dis season and wit England connection (Saka, Rice, and Eze) e go easy for am to settle in."