BBC Pidgin of Monday, 13 October 2025

Source: BBC

When and how Cameroon presidential election result go dey announced

Cameroonians dey wait for di result of di presidential election wey hold on Sunday, 12 October Cameroonians dey wait for di result of di presidential election wey hold on Sunday, 12 October

Cameroonians dey wait for di result of di presidential election wey hold on Sunday, 12 October.

According to di Cameroon electoral code, di Constitutional Council wey go announce di result get 15 days to declare di official results from di day di polls close.

Polls bin close on Sunday for di West African nation and vote counting dey on.

Cameroon Interior Minister Paul Atanga Nji tok say di voting exercise dey "hitch-free" across di kontri.

Dis dey come despite reports of clashes between supporters of Issa Tchiroma Bakary, wey be leading opposition candidate and former President Biya paddy for Garoua – im hometown and stronghold.

Di supporters bin clash wit security forces wey fire teargas to stop dem make dem no gada around Tchiroma house.

However, despite di tension for di north, Interior Minister Paul Atanga Nji insist say di election dey free and fair wit no major incidents for all ten di regions of di kontri.


  • Click here to join BBC Pidgin Whatsapp Channel
  • Voting close, counting start for Cameroon presidential election
  • Who be di hostages wey dem release from Gaza?

Ova eight million registered voters bin take part for di election to choose a new leader from among di ten candidates wey dey eye di number one job – among dem na di incumbent President Paul Biya wey don dey for power for ova forty years.

Di presidential election bin come for di middle of inflation, youth unemployment, security challenges, corruption, and poor social services.

Among Biya challengers for di race na two of im former northern allies, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari. Dem don criticise di president style of governance and dem promise to bring change.

Several voters tok say dem hope say di next president go bring change to di kontri wey get many problems, wey include poor social services.

Analysts say Biya wey no ever lost an election throughout im 43-year rule na di favourite to win di election, as di main opposition leader Maurice Kamto bin dey excluded from di race.

When dem go announce di result?

Di Constitutional Council dey expected to declare di official result on 27 October – wey be 15 days afta di polls close.

Within dis period, di Council go hear petitions or appeals from aggrieved parties and candidates.

Na afta di ruling on di petitions, di council fit come announce di results and declare di winner of di election.

If afta di 15 days, di council no declare any winner, maybe sake of say di election dey cancelled, di incumbent president go remain for office until dem conduct new election.

Di new election go hold within no less dan 20 days and no more dan 40 days afta di date dem cancel di initial election.

Who go announce di result?

Na di Constitutional Council go declare di official results of di election. Na dem get di backing of di law to watch ova di regularity of presidential and parliamentary elections plus announce di results of these various elections.

Dem dey made up of 11 members wey di Head of State appoint.

Dia role na to rule on all petitions wey any candidate or any political party wey take part for di election file, and to rule on any petition wey anybody wey dey serve as a representative of di administration, wey dey request for di total or partial cancellation of election operations.

According to di electoral code, all petitions wey anybody file must reach di Constitutional Council within and not more dan 72 (seventy-two) hours afta di polls close.


  • Cameroon Election: Voters don ready to choose new leader
  • Paul Biya use AI-generated video to market imsef, absent for rally as Cameroon presidential election campaign begin
  • Who be di candidates wey dey run for Cameroon election as Elecam disqualify Maurice Kamto