BBC Pidgin of Friday, 11 April 2025
Source: BBC
Six pipo, including three small pikin dem, don die afta one helicopter wey carry a family of tourists crash into di Hudson River for New York, authorities tok.
Di family of five come from Spain and di sixth pesin na di pilot, na so New York City Mayor Eric Adams tell Tori pipo on Thursday.
All of dem bin dey onboard di helicopter at di time of di crash, wey still dey under investigation.
"Our hearts go out to di families," Adams tok.
Authorities neva still release dia identities, but dem dey widely named as Agustín Escobar and im wife Mercè Camprubí Montal, wey be executives for Siemens, and dia three pikins aged 4, 5 and 11.
Earlier,New York Police Commissioner Jessica Tisch say dem no go release di identities of di victims until dem notify di families.
Video footage of di incident show how di helicopter fall out of di sky upside down and den dive enta di Hudson River.
Officials say di helicopter lose control soon afta e turn for di George Washington Bridge to move along di New Jersey shoreline.
Di helicopter wey dey operated by New York Helicopters and take off from di Downtown Skyport on di lower side of Manhattan at 14:59 local time (19:59 BST).
Di first calls of di crash come around 15:17 EDT (20:17 GMT) and dem send rescue boats immediately, na so New York Fire Commissioner Robert Tucker tok.
"Swimmers bin dey inside di water shortly afta di call," e add.
Once on di scene, rescuers search di water for victims or survivors and begin "immediate life-saving measures" but di efforts no dey successful.
Dem pronouce four victims dead on di scene, while two odas bin dey pronounced dead for a nearby hospital, officials tok.
Di part of di river wia di helicopter crash dey near Manhattan west side, one area wey dey known for dia trendy shops and dining. E also near di main campus of New York University.
Di Federal Aviation Administration (FAA) say na di National Transportation Safety Board go lead di investigation into di crash of di two-bladed helicopter Bell 206.
For one social media post, President Trump say di crash dey terrible and dem go release more details as to wetin happun.
"God bless di families and friends of di victims," na so di president write on Truth Social.
Di Bell 206 dey commonly used by sightseeing companies, television new stations and police departments.
Michael Roth, di CEO of New York Helicopter Charter Inc, tell CNN say e dey "devastated".
"I be father, a grandfather and my wife neva stop to cry since dis afternoon," e tok. Wen dem ask am about di maintenance of di helicopter, Mr Roth say, "na my director of maintenance dey deal with dat wan."
Eyewitnesses wey see di crash tell CBS News, wey be BBC US news partner, say dem see parts of di helicopter as e fall from di sky.
"I look outside my window. I see a few pipo wey dey run towards di water, and some pipo bin dey act normal. So I be like oh, e fit no be anytin. Then I start to hear all di sirens come outside," na so Jersey City resident Jenn Lynk tok.
Anoda Jersey City resident, Ipsitaa Banigrhi, tell CBS say di crash sound like thunder.
"I see, like, black particles flying," she tok. "Again, I tink say maybe na just like, dust, or birds, and then we hear all di emergency vehicles and sirens dey pass, and na dat time I come tink say, OK, wetin dey happen."
Dis no be di first deadly tourist helicopter crash for New York City. For 2018, anoda tourist helicopter bin crash into di East River and all five passengers drown. Only di pilot survive.
In 2009, one helicopter wey carry Italian tourists bin jam wit a private plane over di Hudson River, killing nine pipo.
