BBC Pidgin of Wednesday, 8 October 2025

Source: BBC

Wetin we know about death of soja wey die afta im wife allegedly start fire for dia house

Di Nigerian Army 2 Brigade don confam di death of Lieutenant Samson Haruna, di Regimental Medical Officer of 6 Battalion, wey im wife allegedly kill.

Tori of di death of di young officer go viral on Tuesday for social media and e begin raise conversations.

According to statement from di Nigerian Army 2 Brigade, wey Lawal Bala Muhammed sign, di Nigerian Army di man die from di burns wey im get sake of domestic violence between im and im wife Mrs Retyit Haruna.

Na for dia house for Wellington Bassey Barracks, Ibagwa, Akwa Ibom State, di incident happun on 22 September 2025.

"Preliminary investigation reveal say di tragic incident occur afta heated argument between di couple, wey reportedly stem from family crisis, wey escalate wen Mrs Haruna allegedly set ablaze properties for di house and di fire catch di officer too."

Di Assistant Director, Army Public Relations add for di statement say dem bin later stabilise di officer afta di incident but im no survive.

"Doctor Haruna bin sustain severe burns, but dem bin initially stabilise am for di Battalion Medical Facility, and later transfer am to di University of Uyo Teaching Hospital for further treatment, wia im unfortunately pass away for di early hours of Tuesday 7 October 2025."

Di Nigerian Army say dem "strongly condemn" di act of domestic violence as dem tell di families of Lieutenant Haruna "sorry".

Nigerian Army add say dem dey wait for di outcome of di military police investigation as dem beg all di parties wey dey involved to calm down.

How Nigerians react

Since dis tori go viral some Nigerians don begin react to am for social media, while some pipo dey para sake of di life wey don loss, odas tink say di woman wey allegedly set her husband ablaze no go just do am like dat.

Domestic violence for Nigeria

Domestic and gender based violence na global issue wey dey sensitive and emotional as e dey most time claim lives.

Tori about spouses wey dey kill each oda full social media and Nigeria govment dey try to handle dis social issue.

Former Minister of Women Affairs Barr Uju Kennedy -Ohanenye bin tok say di govment no dey rest as dem dey get reports of domestic violence but di irony be say most women dey beg make dem no carry dis men go court.

'We go join any woman wey beg for her husband afta e beat her as accomplice for court case'

She bin also tok about cases wia women dey also beat and abuse dia men for marriage and relationships.

Di former Minister of Women Affairs wey be lawyer too tok say dis mata dey difficult to fight sake of say sometimes, di same pipo go allegedly threaten di woman wey dem beat to withdraw di case, di woman too go begin beg make dem release her husband make dem no carry am go court.

Apart from Nigeria govment oda popular Women Rights Advocay groups including di United Nations dey campaign against am. But uptil now di mata still dey ground.