Di health minister for Ghana don set up committee to chook eye for one incident wey involve group of young pipo and healthcare staff for Ridge hospital for Accra.
Di minister Kwabena Mintah Akandoh give di committee seven days to submit dia report.
Dis na afta some young pipo allegedly attack some nurses on duty for di emergency ward of di hospital on 18 August wen dem carry accident victims go di place.
According to di group wey one popular activist wey im name na Ralph Saint Williams bin dey lead, di nurses and oda staff for di emergency ward neva show any urgency to attend to di accident victims, wey some bin dey critical.
Since di mata happun, many groups and pipo don react wey some say dem dey surprised say police neva arrest di social activist yet.
But wetin we know about di kasala wey happun ?
Why youth storm di hospital
Ralph St Williams wey dey associated wit #FixTheCountry and #DemocracyHub, groups wey bin dey advocate for good governance and oda tins for di citizens, bin stream live on top Facebook for di emergency ward dat night.
Inside di video, im dey complain say nurses for di hospital emergency ward neva respond to di emergency cases wey dem carry go di facility.
Ralph wey also get injury for im fingers bin dey bleed wey im say di healthcare staff no dey rush to try and stabilize some of di victims wey bin dey critical.
Im show oda patients for di hospital wey bin dey suffer and how nobody dey attend to dem.
"Pipo dey here since, more than one hour, di nurses no dey mind dem. If anytin happun to pipo hia, we go deal wit dis nurses."
Ralph tok say "I dey bleed for hand since, nobody dey attend to me."
Inside di video, many young men dey visible for di emergency ward wey dem dey shout and complain about di nurses.
Di video also show policemen for di hospital wey dem dey try to calm tension and ask di youth to leave di accident ward.
Afta more dan 20 minutes, police calm tension wey di youth ride dia motorbikes wey dem comot di hospital.
Di youth allegedly assault some nurses
One nurse narrate how di youth attack her wen dey storm di hospital dat night.
She explain say "Ralph bin ask dem to leave all di cases make dem attend to im and im pipo."
"My boss wey dey in-charge tok am say make im get hospital card make di process start, na so im vex wey im begin to insult us wey im begin to video us," di nurse wey dem bandage her hand narrate.
She continue to explain say "na me even give im pressure dressing for di wound for im fingers, but im comot di gauze wey im begin to shout. We tok am say we get two trauma cases and odas wey we gatz to attend to, but im vex wey im attack me."
Di nurse further explain say "afta Ralph comot, I neva know where di guys comot, dem bin enta di ward, some of di nurses bin see di youth early so dem take cover, but I neva see dem on time, na so dem begin to hit me from my back, my shoulder, my face and all my body."
<>Ridge hospital, health ministry condemn di incident
Afta di video of di incident bin go viral, di Ridge hospital issue statement wia dem tok say di presence of di youth for di facility dat night "disrupt smooth delivery of care wey e cause tension and threaten di safety of our clinicians."
Di statement wia tok tok pesin Juliana Haruna don sign add say "dem assault one of our dedicated staff, sometin wey be unacceptable."
"Hospital management bin call di police during di kasala wey dem restore calm bifor our clinicians continue to dey work dat night."
She add say "any form of interference, aggression or assault towards our staff na unacceptable wey e dey put lives at risk."
"We don dey remind di public say to dey take photo or video of patients and clinicians without dia consent dey prohibited for di facility, sake of e don dey breach privacy and hospital regulations."
Di health ministry also don condemn di incident wey happun for di hospital.
Di ministry tok say dem bin take steps to increase security for di hospital wia dem chook eye for di mata.
"Di ministry dey investigate wetin lead to di reported delay in care and address di gaps wey don contribute to di wahala."
Tok tok pesin for di ministry oga Tony Goodman say "di ministry bin dey take di mata seriously sake of dis kind tin fit endanger di lives of patients and staff."
Staff for di hospital don brief di health minister Kwabena Mintah Akandoh about wetin happun for dia dat night.
"We don set committee to investigate di mata within one week, so dat di law go take its course," di minister tok journalists.
Im add say im visit di hospital to assure di staff say govment to protect dem so make dem continue to dey do dia work.
"To attack health workers na bad tin, we no go encourage dat kind tin, so di law gatz to work, if dem bin assault di staff, na crime."
Registered nurses and midves give ultimatum
Di nurses and midwives association call on di police to arrest Ralph Saint Williams.
Dem join oda groups like di minority lawmakers for parliament to demand dis arrest sake of im lead di boys to assault healthcare workers for di facility.
Inside one statement, di association say "di police gat to act swiftly and arrest di ring leader and im accomplices wey don carry out di violent attack on di healthcare professionals within 48 hours."
"If di police fail to do dis, we go take our own actions as an association to ensure say nurses wey dey work for di hospital, especially di emergency unit, dey safe."
https://cdn.ghanaweb.com/imagelib/pics/492/49291274.jpg
Ralph Saint Williams vex say hospital staff no respond quick to emergency as dem carry critical accident victims go di facility.

Di health minister tok say make committee investigate di mata and submit report in seven days











