BBC Pidgin of Monday, 30 March 2026
Source: BBC
Security services don confam say three pipo die as one three-storey building structure on top one school compound bin collapse on Sunday.
Di uncompleted building wey bin dey di Accra Newtown experimental school compound according to residents bin dey dia for more than 10 years.
Rescue officers visit di scene afta di accident wey dem spend many hours to rescue survivors – togeda wit sniffer dogs from di military and narcotics control commission.
As at Sunday night when dem still bin dey try to rescue pipo, dem find at least 20 survivors.
Di kontri interior minister Mohammed Muntaka Mubarak tok journalists say di security services bin do dia best to deal wit di situation.
"Afta checks wit all di security agencies, we fit confam say three pipo don die. One male and two females. Di rescuers also bin find 20 victims' 15 of dem be female."
Di minister tank di police, fire service, national disaster management organization (Nadmo), di ambulance service and oda residents for dia effort during di disaster.
Residents say di building wey collapse bin dey look weak for many years but nobody deal wit am.
"Dat building dey serve as church for some pipo for long time. Na building wey belong to di school wey dey here – but for many years, na so e dey stand for dia. Di pillars all bin dey weak," one resident tok journalists for di site.
Di national ambulance service say dem work wit security agencies to transport di victims to various hospitals as at midnight of Sunday.
"We don carry nine patients go di 37 military hospital, seven pipo dey di police hospital, three victims dey di Ga North Municipal hospital while one pesin dey di University of Ghana medical center."
Di ambulance service confam say "further transfer dey go on to ensure say di victims get proper care and effective case management".
Di interior minister Mohammed Muntaka Mubarak say di rescue operation don end by midnight, as dem now begin to clear di debris.
But di security services and di ambulance service dey remain on di site.
Overnight, excavators and oda machines bin work for di site to clear di debris.
As at 7AM (GMT) Monday morning, di fire service and di oda security agencies bin dey clear di rubble.
School authorities for di New Town experimental school don cancel classes today as dem continue dey clear di accident scene.
Police don begin investigation for dis accident, wey happun 14 years afta one shopping plaza bin collapse wey kill nine pipo.

