BBC Pidgin of Tuesday, 29 July 2025

Source: BBC

Wetin to know about new Arsenal striker Gyokëres and oda transfer deals so far

As leagues around di world don dey prepare to start again for di 2025/26 season, teams dey sign players to boost dia squads.

Mikel Arteta for Arsenal wey don face ogbonge backlash say im fail to sign players for im last few seasons, now sign at least four players for dis window.

Im already sign Martin Zubimendi, Noni Madueke, Christian Norgaad, Kepa Arrizabalaga and Christian Mosquera.

Di latest na Swedish Striker Victor Gyokeres wey don join di English club afta weeks and months of drama.

Tins to know about Arsenal new striker Gyökeres

Im be ogbonge striker wey bin play for Brighton during im academy days bifor im sign for Sporting CP for Portugal.

Im score 68 goals for 66 games between 2023/25 for Sporting.

Im get three league titles and one national cup for im career wey im win seven primeira player of di month awards, im collect back-to-back golden boots for 2023/24.

Gyökeres go wear di number 14 jersey for di gunners.

Pervis Estupinan join AC Milan

Di Ecuador defender wey bin dey play wit Brighton don sign deal until 2030 for di Italian club.

Im bin play 104 games wit five goals for Brighton since im join dem from Villarreal for 2022.

Im already begin to dey play for AC Milan during dia pre-season.

Liverpool sign striker Hugo Ekitike

Di reds don sign di 23-year-old French striker from Eintracht Frankfurt.

Im don join Florian Wirtz wey sign British transfer record fee of £116m, togeda wit oda players like Milos Kerkez and Jeremy Frimpong.

Ekitike bin score 15 goals out of 31 starts wey im provide eight assists.

Afta dis signing, Liverpool bin dey chase Newcastle striker Alexander Isak, wey don tok im club say im go want to leave di club.

Luiz Diaz go join Bayern Munich

Di Colombian forward dey set to become di latest Bayern Munich player afta di German champions gree for one deal worth £65.5m.

Di 28 year-old na target for Barcelona bifor im join Bayern Munich.

Last season im score 17 goals for all competitions wia im go help Bayer to win more titles.

Rodrigo De Paul join Messi for Miami

Argentina and Atletico Madrid midfielder don join im bestie Lionel Messi for di MLS.

Im join Inter Miami for di rest of di season on loan wit option to stay.

Di World Cup winner don play 134 games wit 11 goals for Atletico Madrid.

Rashford join Barcelona on loan

Last week all di headlines na about Manchester United forward Marcus Rashford wey bin join Barcelona.

Im get di number 14 jersey wey im already play 30 minutes for di club dia first pre-season friendly for Japan.

Im coach go expect say im go dey full fitness bifor di start of di season to help di team.

Barcelona get di choice to sign di Englishman permanently afta dis loan deal

Granit Xhaka don sign for Sunderland

Xhaka don return to England afta im join Bayer Leverkusen.

Di Switzerland midfielder and im team don gree fee around £17m.

Sunderland agree di deal wey di 32-year old wey already land for England, go sign 3-year.

Xhaka play 33 bundesliga games last season wey im score two wit seven assists.

Bifor im join Leverkusen, Xhaka play for Arsenal wia im score 23 goals and 26 assists gpr 297 games.