You are here: HomeAfricaBBC2023 02 13Article 1713545

BBC Pidgin of Monday, 13 February 2023

Source: BBC

Wetin make Nigerian pastor cari AK-47 enta pulpit?

File foto File foto

Gun ontop pulpit?, one senior pastor for Nigeria become hot topic of discussion ontop social media over di weekend afta im cari rifle climb ontop wia im dey deliver sermon.

Presiding Pastor of di Abuja chapter of di House on the Rock Church, Pastor Uche Aigbe, cause a stir during Sunday Service wen im mount di pulpit dey cari one AK-47 rifle.

Dis na unusual sight, away from di bible, anointing oil, or keg of holy water wey men of God dey usually cari follow body go pulpit.

But wetin make Pastor Uche cari AK47 to church?

‘Guard your faith’

Dis be di theme of di sermon on Sunday, according to wetin di church put for dia Facebook page.

So pastor Uche bring di gun come church to use as illustration on why church members ‘need to cari dia guns and defend dia faith’

“E get some tins wey no get anytin to do wit di gospel, God no be magician, God no be diviner, yes, im sabi anytin from di past to di future, but im no dey use your past to manipulate you, na why you need to cari your guns and defend your faith” Pastor Uche tok.

Wen im first climb di pulpit, di church members bin first laugh at di unusual sight of di gun wey im strap to di back, but di senior pastor say make dem no “go anyway, stay dia, I come prepared dis morning because I need to guard my faith”, e tok as e raise di gun up to show dem wetin e mean.

“We dey live in a time wia we need to protect our faith against but we need to guard our faith against hoodlums, against bandits, against wicked pipo wey dey seek to turn di faith of God for our lives , make dem fit stop wetin God wan do for our lives”, e add am.

Meanwhile, di sight of AK-47 for church make pipo tok on social media as some pipo defend di action say e dey clearly use am to illustrate, odas wonder if e dey right for am to even own a gun or bring am come church to perform.

How pipo react