You are here: HomeAfricaBBC2023 12 07Article 1894598

BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023

Source: BBC

Wetin don change for di UK visa requirements?

File foto File foto

Di goment don bring out measures to take reduce di number of pipo wey dey enta UK.

Home Secretary James Cleverly say di changes go bring di biggest cut on net migration and e go start from next spring.

Dis na afta net migration wey be di amount of di pipo wey dey come stay UK minus di pipo wey dey comot, don reach record number of 745,000 last year.

Minimum salary for UK skilled worker visa go increase

To fit get skilled worker visa to go UK, you job first must reach di minimum salary requirement.

For now na di highest of £26,200 per year, £10.75 per hour or di "going rate" for your kain work.

From next spring e go rise go £38,700 per year.

But health and care workers wey reach almost half of di pipo wey dey enta on work visa no go enta dat requirement.

Pipo wey dey for national pay scales like teachers no go need meet di requirement too.

Di Migration Observatory say di main impact fit mostly be di middle skilled work like butcher or chefs, wia dem dey pay less dan £30,000.

Minimum income requirement for family visa go rise

Di minimum amount of money wey British citizens go need make if dem wan carry foreign family member or partner come stay wit dem don rise from £18,600 to £38,700 a year.

About 70,000 pipo enta UK wit family visa wit di year wey dem end for June 2023.

As di change dey affect those wey get lower income, e go also get bigger impact for groups wey no dey earn like dat, like women, young pipo and pipo wey dey live outside London and south-east England

Ban for care workers wey wan carry family dependants come UK

Oversea care workers no go fit carry dia partner or pikin dem follow bodi come UK again.

Home Office data show say na health and care workers fit dey carry family join bodi pass pipo for oda work visas.

From di year to September, e pass 101,000 visas bin dey given to care workers wit like 120,000 visas wey bin dey given to associated dependants.

Care companies dey worry say di ban on dependants go make potential recruits to no wan come UK and e go make di mata of staff shortages worse.

But goment say dem believe say dem go still be high demand from oversea workers for care roles inside UK, even if pipo no fit carry family follow bodi.

Dem scrap salary discount for shortage occupation list

As at now jobs wey dey di shortage occupation list fit dey paid at 80% of wetin di going rate of di work be to qualify for skilled labour visa.

Dis list bin cover all kain sector like health, education, care work and construction and e dey designed to make am easier for employers to fill vacancies wey shortage of dat kain workers dey for UK.

Di goment say na so immigration no go dey rip British workers na why dem dey comot di 20% discount.

For students, dem dey review graduate visa

Graduate visa dey allow pesin to stay for di kontri two years afta dem finish dia course for UK.

Di goment don start review for dis visa route to dodge wetin dem call di "abuse" of di system.

E pass 98.000 graduate visa wey dem don give pipo in di year till June.

Di goment don already annouce say dem get plans to limit di number of students wey fit carry family members go wit dem to UK.

Di changes go start for January and dey comot di right of international students to fit bring dependants unless dem dey do postgraduate research courses.

Students, also no go fit switch to work visas before dem finish dia studies.