You are here: HomeAfricaBBC2023 10 24Article 1867994

BBC Pidgin of Tuesday, 24 October 2023

Source: BBC

Wetin dey happun for Israel and Gaza, and why now?

Hamas military wing, di Izzedine al-Qassam Brigades, destroy Israeli tank for Gaza City on 7 Oct Hamas military wing, di Izzedine al-Qassam Brigades, destroy Israeli tank for Gaza City on 7 Oct

Di Palestinian militant group Hamas launch attack on Israel on 7 October, wey kill more dan 1,400 pipo and hold more dan 220 hostages.

Gaza health ministry say more dan 4,600 pipo don die in di territory since Israel launch retaliatory air strikes, and ground offensive dey expected.

Wetin dey happun for Gaza Strip?

Di UN don warn say Gaza desperately need "humanitarian aid".

About 34 lorries carry food, water and medical pass through di Rafah border after e cross Egypt border ova di weekend.

However, dis only provide small portion of di need of pipo wey dey Gaza, bifor dem dey receive 400 to 500 lorries evri day.

Di UN agency for Palestinian refugees, Unrwa, tok say di access to clean water don limit and "high concern don dey ova dehydration and waterborne diseases".

Estimate of 1.4 million pipo for Gaza dey displaced, according to di UN.

Hundreds of thousands move from di north of di territory to di south, afta Israeli military tell dem make dem commot for dia own safety.

Di southern city of Khan Younis, na home to 400,000 pipo, but di population don increase to more dan one million. Many families dey share rooms, or sleep for tents.

However, Israel don kontinu airstrikes ova wetin dem call Hamas military targets for southern Gaza.

Some of dos wey initially run from di north of Gaza don dey return becos di situation for south dey bad, di UN tok.

Di World Health Organization don warn say "e dey almost impossible" for hospitals patients wey dey northern Gaza to evacuate.

Israel go invade Gaza?

Israel say di goal na to destroy Hamas.

Defence Minister Yoav Gallant tok dis on Sunday say di next stage of di operation na Gaza - expected ground offensive - " e fit take a month, two or three, but at di end Hamas no go dey dia again".

Israel also wan bring back di hostages wey Hamas dey hold.

Israel don mount tens of thousands of soldiers along di Gaza perimeter fence, along wit tanks and artillery. Dem don activate some 300,000 reservists and 160,000 standby force.

Hamas get about 25,000 militants, di Izzedine al-Qassam Brigades.

Di Israeli military don prepare for offensive by bombarding hundreds of targets inside Gaza.

One of im main targets na Hamas big operation wey dey underground tunnels, e contain bunkers for leaders and operational headquarters.

Hamas dey claim say di tunnels stretch for 500km (310 miles). Many get hidden door within houses, mosques, schools and oda public buildings.

Israel troops dey avoid to go into tunnels unless dem go need to go dia, instead dem dey use explosives to destroy dem.

One major challenge for di Israeli troops na close-quarters fighting for di urban areas. Hamas fit lay booby traps and improvised explosive devices for doorways, and narrow streets.

On Monday, di Israeli military say one Israeli soldier die and pipo injure during raid into Gaza to search for di bodies of missing Israelis and to clear di way for a ground attack.

Di leaders of di US, UK, Canada, France, Germany, and Italy on Sunday "reiterate dia support for Israel and im right to defend demsef against terrorism" and call for "adherence to international humanitarian law, including di protection of civilians".

Violence don high for West Bank and Israel northern border wit Lebanon, wia di Israeli military say e don carry out strikes on targets wey belong to Hezbollah in response to attacks.

Who be Hamas and wetin dem want?

Hamas na Palestinian militant group wey don rule Gaza Strip since 2007. Di group don swear to destroy Israel and turn am to Islamic state.

Hamas don fight several wars wit Israel since e dey power. E don fire or allow oda militant groups to fire - thousands of rockets into Israel, and e don carry out oda deadly attacks.

In response, Israel don repeatedly attack Hamas wit air strikes. For 2008 and 2014, Isreal send troops to Gaza.

Togeda wit Egypt, e don block di Gaza Strip since 2007 ova wetin e dey call security reasons.

Hamas - or in some cases im military wing, di Izzedine al-Qassam Brigades na one terrorist group wey Israel designate, di United States, di European Union and di UK, as well as oda powers.

Iran back di group, as e dey provide funding, weapons and training.

Why Hamas launch im latest attack?

Hamas storm Israeli communities on 7 October, dem kill more dan 1,400 pipo, di most serious cross-border attack Israel don face for more dan one generation, di BBC international editor Jeremy Bowen tok.

Militants breach di wire wey separates Gaza from Israel for multiple places.

Details of one massacre for one Israeli community, Kibbutz Kfar Aza.

Survivors don estimate about 100 pipo wey dem kill, and many oda wey dem hold hostages. Israeli soldiers tell Jeremy Bowen say dem behead some of di pipo wey died.

Give di resources of Israel security services, e dey surprising say di attack by Hamas no dey expected, di BBC security correspondent Frank Gardner tok.

E come at di time wey Israeli-Palestinian tension dey high.

Dis year na di deadliest record for Palestinians wey dey live for di Israeli-occupy West Bank, e fit don ginger Hamas to strike Israel.

Hamas don dey seek to win propaganda victory to boost im popularity among ordinary Palestinians.

Di capture of Israelis go pressure Israel to free some of di estimated 4,500 Palestinians wey dey Israeli prison.

Speculation dem say di attack na Iran start am, though Iran Supreme Leader don deny say im kontri dey involved.

Wetin be di Gaza Strip and who dey live dia?

Di Gaza Strip na 41km (25-mile) long and 10km-wide territory wey dey between Israel, Egypt and di Mediterranean Sea.

Originally na Egypt dey Gaza, Isreal capture di city during di 1967 Six Day war.

Israel withdraw im troops and about 7,000 settlers from di territory for 2005.

Gaza na home to 2.23 million pipo and na one of di highest population densities in di world.

Just ova 75% of Gaza population - some 1.7 million pipo - don register as refugees or descendants of refugees, according to di UN. More dan 500,000 of dem dey live for eight camps wey dey located across di Strip.

Israel don control di air space ova Gaza and im shoreline, and dem dey control di movement of pipo and goods.

Dem don close crossings border for Erez and Kerem Shalom, Isreal say dem no go open di border until Hamas return all dia hostages.

Wetin be Palestine?

Di West Bank and Gaza, East Jerusalem and Israel, form togada as part of a land wey we know as Palestine from Roman times until di mid-20th Century.

Dis na also di Jewish kingdoms inside di Bible, and na so Jews see am as dia ancient homeland.

Israel don declare demself state for 1948, though pipo wey no recognise Isreal as di owner still dey call di land Palestine.

Palestinians also dey use di Palestine name as di umbrella term for di West Bank, Gaza and East Jerusalem.

Di Palestinian president Mahmoud Abbas, also known as Abu Mazen dey live for West Bank, wey Israeli don occupy.

E don be di leader of di Palestinian Authority (PA) since 2005, and represent di Fatah political party, one bitter rival of Hamas.