BBC Pidgin of Tuesday, 29 July 2025

Source: BBC

Wetin dey cause di deadly protests for Angola?

Parts of di capital, Luanda, standstill on Monday Parts of di capital, Luanda, standstill on Monday

Police for Angola say four pipo don die and dem don arrest 500 pipo afta protests for di capital, Luanda.

Wetin begin as three-day strike by taxi drivers against rising petrol prices don escalate into one ogbonge wave of protest di country don ever see in recent years.

Thousands of pipo follow for di demonstrations for di capital on Monday, 28 July, dem block roads, loot shops, destroy cars, demonstrators and police also clash.

Di protests continue for Luanda on Tuesday, 29 July, dem loot more shops and clashes between police and demonstrators continue.

Why Angolans dey protest?

"Di fuel price issue na di last straw wey spark di widespread public discontent... Pipo don tire. Hunger dey everywia, and di poor dey become more miserable," one popular local activist, Laura Macedo, tell BBC.

Na taxi operators call for di strike in response to govment decision to increase di price of diesel by ova 33%, one measure dem introduce for early July as part of plans to remove fuel subsidies for di oil-rich nation.

Dis no only lead to higher cost of transportation for urban Angolans wey rely on di taxis, but e also don increase di price of food and oda basics - as suppliers wey dey transport those goods by road dey pass on di additional costs to consumers.

But President João Lourenço don ignore dis concerns, e say di protesters dey use petrol prices as disguise to undermine di govment.

"Even afta di increase, di price of diesel for Angola na still around 40 US cents [per litre], and countries wey still get dis kain low prices no many for di world," e tell CNN Portugal for one recent interview.

Di average monthly wage for Angola na just 70,000 kwanzas ($75; £56), and di presidency promise to increase am to 100,000 kwanzas neva come into effect.

As pipo pour out dia frustration on Monday, groups of protesters bin enta streets for various parts of Luanda, dey kick against di fuel price increases, dey vent against di nearly five decades of rule by di governing MPLA party and dey express dia frustration wit di country current state of affairs.

State-run media for Angola bin come under heavy criticism on social media say dem continue wit dia regular programming and dem fail to cover di demonstrations.

By Monday evening, di MPLA warn young pipo say make dem no join di protests and add say dis "acts of vandalism dey deliberate and di intention na to tarnish and hinder di joyful celebration" of Angola 50th anniversary of independence.

Local authorities for Luanda on Monday also issue public statement wia dem express "deep concern" on top di events, wey dem describe as "disturbances and acts of vandalism wey dem link wit di forced halting of taxi services".

According to di statement, di strike wey taxi organisations originally announce, don dey called off afta negotiations wit authorities.

However, dem tok say, "groups of unidentified individuals, wey no get any legitimate representation wit di taxi sector, bin resume di call for strike actions, and dem promote intimidation and violence, including attacks on vehicles wey dey move on public roads, even those wey no dey provide taxi services".

Much of dis protests bin dey spontaneous in nature.

One major taxi association, Anata, don distance diasef from Monday violence but dem vow to continue di three-day strike, dem say "di voice of di taxi drivers show di outcry of di Angolan pipo".

As of Tuesday afternoon, major shops, banks plus oda businesses no open. Some civil servants don return to work, but many pipo wey work for private companies stay for house on di advice of dia employers.

Police warn say dem dey patrol di streets and go continue to "intervene any wia dem see disturbances" to "re-establish public order and peace".






Dem raid some shops for di capital, Luanda