BBC Pidgin of Thursday, 24 April 2025

Source: BBC

Wetin dey cause NiMet strike wey dey affect airlines and passengers

Some local airlines for Nigeria don suspend all dia flights sake of industrial action (strike).

Some staff of di Nigeria Meteorological Agency (Nimet) wey dia work na to provide information about di weather dey on strike.

Tori be say di workers wey start dia indefinite strike on Wednesday 23 April, 2025, dey protest sake of dia welfare packages wey no too make sense.

As e be so dem don withdraw dia services for all airports across di kontri and dis action dey affect some passengers and airlines.

According to local media The Guardian, dem quote di Assistant Chief Meteorologist for di Central Forecast office, Department of Weather Forecast Services, Nimet, Mrs Ibiam Aderonke, wey tok say di workers dey ask for welfare wey relate to dia salary, sake of say dem be one of di most important service providers for di Ministry of Aviation and di kontri.

"NIMET na di only agency wey you get level four officer wey no dey collect di minimum wage agreement wey dem reach for 2019, let alone di 70,000 naira ($43) minimum wage.

Some of our employees dey collect 28,000 naira ($17) and we dey tok say e no dey enuf to meet di needs of dia families and to provide di quality service wey Nimet dey known for."

Di Guardion add say di Deputy National President of di National Union of Air Transport Employees (Nuate), Samuel Uzor, dey regret say di management neva meet any of di agreements wey dem bin enta wit di union since 28 January.

Sake of dis strike some local airlines don cancel all flights since Wednesday till further notice, while others still dey operate.

Airpeace cancel flights

Airpeace na one of di airlines wey cancel all dia flights indefinitely. One video wey bin go viral on Wednesday show wia di oga of Airpeace Allen Onyema tok say make dem cancel all di flights.

For inside di video oga Allen bin dey tok for phone wit pesin we sound like im staff.

Di pesin bin dey ask am for di phone call weda make dem fly, but oga Allen respond in di negative.

Im give order make dem cancel all flights till further notice or wen di Nimet workers resolve dia strike mata.

However, bifor di video, Airpeace for dia official X handle on Wednesday morning bin no announce outright suspension.

Dem bin only tok about flight disruptions wey fit include "...possible flight delays and cancellations...

We dey currently monitor di situation and we dey work wit relevant stakeholders to reduce di impact on your travel plans."

United Nigeria

Meanwhile, di United Nigeria airline say despite di strike dia flight operations still dey available.

For statement wey tok-tok pesin, Chibuike Uloka sign and release on Thursday 24 April for di office handle, United Nigeria Airline say dia flights operations " remain safe, reliable and compliant wit regulatory standards despite di ongoing industrial sction by di Nigeria Meteorological Agency."

Dem say despite di strike dem get alternative sources wey dem fit use get weather reports like real time satellite monitoring, pilot weather reports and coordination wit air traffic control services and more.

Wetin dis statement mean be say, flight operations go continue as usual for United Nigeria Airline across di kontri.

Tori from BBC Pidgin tori pesin wey visit di Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja, di Nigeria capital comfam say activities dey go on for di airport despite di strike.

Our tori pesin wey visit di airport on Wednesday morning say lines like Ibom, Aero, Max air, United Nigeria, and Arik dey fly.

Im see passengers dey check -In as dem also make boarding calls for di airport.

However, passengers of Airpeace wey bin get flights dis morning no fit fly afta dem Check-In.

Dem later tell di passengers wey don already Check-In say dem no go fly, one Airpeace flight wey bin don reach runway and bin dey ready to take-off gatz comeback.

One official of di Federal Airports Authority of Nigeria (Faan) tell BBC Pidgin say besides di order from Airpeace oga Allen Onyema, Airpeace pilots wey many of dem na expatriates dey fear to fly.

Di pilots also say dem no go fit take di risk to fly without a Nimet report, na why dem ground all flights.