BBC Pidgin of Tuesday, 9 December 2025

Source: BBC

Wetin be di new Canada permanent residency pathway 2026 wey involve international doctors

Canada don drop update for permanent residency Canada don drop update for permanent residency

Canada don drop update for how dem go start to dey handle di mata of Permanent residency for di kontri, say dem wan focus for registrations from inside di kontri.

For update, dem reason say, "Canada don dey prepare for major shift for dia permanent residency system for 2026 as di federal goment dey move well-well to prioritize in-Canada applicants".

Dem go on to torchlight say di federal budget wey get di Immigration Levels Plan 2026-2028 suppose start two major programs for permanent residency for 2026.

Di two programs na large scale temporary resident to permanent resident initiative and quicker PR pathway for pipo wey get US H-1B visa.

Di large scale transition program, even though tori about how e go run neva dey wella, dey plan ot ginger 33,00 temporary work permit holders to permanent residence from 2026 to 2027.

Dis plan dey target pipo wey dey already live and work for inside di kontri. Dem don do dis kain large scale waka for 2021.

Di second one na for di pipo wey get US H-1B visas.

Di plan na to attract high skill professionals from di United states wey get skills for technology, healthcare, engineering, scientific research and innovation driven indistries.

dem bin first try dis program for 2023 for 10,000 applications and tori be say e take just hours bifor e full.

Wetin be di plans for International Doctors for Canada

Meanwhile, di Honourable Lena Metlege Diab, Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, and Maggie Chi, Parliamentary Secretary to di Minister of Health announce on Monday say dem go create road to permanent residence to dey simpler for international doctors.

Di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) go start new Express Entry category for international doctors wey don get at least one year Canada work experience.

Those invitations for di category go start to dey issued from early 2026.

Canada goment say dem go reserve 5,000 federal admission spaces for provinces and territories to fit nominate licensed doctors wey get job offers.

Doctors wey dey nominated go get 14 day sharp sharp work permit processing. Dis process mean say dme go still fit work as dem dey wait dia permanent residency.

Di Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, Lena Metlege Diab tok say, "dis dedicated Express Entry category, wit di reserved federal admission spaces for provinces and territories go help bring ready made doctors so pipo all ova Canada go fit get di care wey dem need."