BBC Pidgin of Friday, 11 April 2025

Source: BBC

Wetin be di fate of major opposition parties for Nigeria?

Atiku Abubakar/Peter Obi/Nasir El-Rufai Atiku Abubakar/Peter Obi/Nasir El-Rufai

Nigeria now be like one-party kontri as di two major political parties dey scata wit internal wahala wey dey tear dem, Political sabi pipo tok.

Olalekan Ige, wey be political analyst, tell BBC Pidgin say di way tins dey, both di Peoples Democratic Party (PDP) and di Labour Party - wey bin get combine 13 million plus votes for di 2023 presidential election - no fit present any strong opposition to di ruling All Progressive Congress (APC).

Since afta di election, na one wahala afta di oda for di two opposition parties, one court case afta anoda, and dis don make plenty of dia high profile members to jump enta di ruling party.

Out of di four off-cycle govnorship elections wey don happun since afta di general election - for Bayelsa, Edo, Kogi and Ondo States - di APC don win three, including for Edo wia dem beat a PDP goment.

Leadership crisis for Labour Party get worse

Recently, di Supreme Court give judgement wey many pipo bin tink say e don settle di leadership tussle for inside di Labour Party, but di judgement be like say e don make di mata worse.

Instead of two pipo wey bin dey claim leadership of LP, na three pipo now dey drag di position - Julius Abure, Ms Nenadi Usman, and Lamidi Apapa.

Di Supreme Court judment decide say di matter of who go lead a political party dey for di hand of di party membas to decide and court no get hand dia.

On Wednesday, Apapa, wey be di former National Deputy Chairman of LP declare imsef chairman of di party as e tok say since di court don comot Abure, "I, Lamidi Apapa, di most senior deputy national chairman, and according to our party constitution, don take over di running of di affairs of our great party wit effect from today".

Apapa bin don follow Abure drag di national chairmanship of LP until court remove am, but e don come back again.

Dis dey come on di same day wey Nenadi Usman who be di national caretaker chairman of LP and some top-top oga dem for di party, bin do meeting for Abuja to decide how to take dia party forward afta di Supreme Court judgement wey dem say e comot Julius Abure for office.

Ms Usman bicom di caretaker chairman afta di National Executive Council meeting of di party wey happen for Umuahia Abia State in 2024.

But Abure and im faction say dem no recognise dat NEC meeting as dem tok say di pesin wey convene di meeting - govnor Alex Otti of Abia State - no get power for dia constitution to convene such meeting.

PDP crisis get deepeer

Similar tin also happun for di PDP concerning di post of dia National Secretary, wia di supreme court rule say di internal leadership of a political party, na dia concern.

Di PDP dey divided wit di party leadership on one side and members loyal to di former govnor of Rivers State and current Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike, on di oda side.

Wike, even though e be PDP member, na also a member of di President Bola Tinubu executive cabinet, and Tinubu na APC e dey.

Dis don make pipo dey tok say PDP don bicom mere extension of di APC.

Olalekan Ige say di lack of opposition power for Nigeria political system na historical tin, "and e no good for di aspiration of di Nigerian pipo to get good governance".

"Even wen PDP bin dey as di ruling party, di opposition parties dey always dey scata. You remember say e take a coalition of three or four opposition parties in 2015 to be able to collect power from (President Goodluck Jonathan).

"Dis na bicos plenty times, di politics for Nigeria no be by ideology but by sef interest. So most times, na wia di interest of di politician dey better served, na wia dem go go."

"However, weneva general election don dey reach, you go see say di opposition parties dey always find dia way around to contest for election, and dis fit be di case again wit PDP and Labour Party."

Anoda opposition merger fit get head?

Recently, Nasir El-Rufai, one of di founding membas of di APC and former gonor for Kaduna State, comot from di party and join di Social Democratic Party (SDP) wey be a smaller opposition party.

Since den, e don dey champion tok make di opposition parties come togeda take defeat di APC for di next presidential election in 2027.

Lekan Ige say di success of dis possible merger go depend on weda di political actors involve go fit swallow dia personal interests and ambitions and present a common candidate to stand election.

On wetin di lack of opposition mean for democracy and good governance for Nigeria, Ige say: "If we no get stron internal democractic practices for di political parties, we go always struggle to get good governance for di kontri."

"If we no fundamentally restructure political parties for Nigeria, Development go dey very far away."