Kenya Ministry of Education don officially release di 2025 Kenya Junior Secondary Education Assessment (KJSEA) results.
Di education ministry say na di first eva junior school assessment results wey dem go release.
Na di Cabinet Secretary for Education, Julius Migos Ogamba, bin officially release di Kenya Junior School Education Assessment (KJSEA) results for di Kenya National Examinations Council offices in Mitihani House, Nairobi, on Thursday afternoon.
Dem say parents, schools and students fit go check for dia results through dia platform wey dem provide.
According to Kenya education, dem release KJSEA results of 1,130,459 learners. "Of dis, 578,630 learners na male, while 551,829 na female, representing 51.19% and 48.81% of di total learners."
Afta dis release, di authority say dem go come begin dey place learners into Senior school.
"Di placement go dey guided by di learner performance and di selected pathway. E dey expected say di Grade 10 learners go report to dia respective schools starting from 12th January, 2025."
Kenya Education ministry say di assessment dey successful despite all di rofor-rofor wey happun fo some parts of di kontri.
Di Education Secretary say di govment happi well well sake of how di assessment bin go, say di officers and schools bin corporate to handle di challenges wey come.
Ogamba say di assessment don show anoda major improvement for Kenya education sector.
Wetin be KJSEA
KJSEA na key assessment tool for di end of Junior School to evaluate how di learners take dey competent and guide how dem go enta Senior School.
According to Kenya authorities, di assessment dey significant and dem don implement di Competency-Based Education.
Di KJSEA go set di stage for di start of of students "wey wan transition to Grade 10 for Senior School next year."
Kenya Education ministry say di KJSEA na for three part wey include to test and evaluate to see if junior students don get di kain knowledge and competence wey dem need for di level wey dem dey.
Dem also say di assessment go help dem get feedback into how dem go place junior students for di department wey fit dem either Arts, Social sciences and Sport science.
How to check KJSEA 2025 results
To check di KJSEA results online, di ministry say make users go dia selection portal and put di learner assessment number for di correct space- and dem go follow wetin dem see.
For pipo wey no get internet, di Ministry say dem get SMS option.
For SMS option di learner go send message to di expected number.











