You are here: HomeAfricaBBC2023 12 01Article 1890956

BBC Pidgin of Friday, 1 December 2023

Source: BBC

Wetin be Climate Change loss and damage fund wey dem launch for COP28?

Vulnerable nations like Sudan go benefit from di new fund Vulnerable nations like Sudan go benefit from di new fund

World leaders currently dey one big UN summit for Dubai for tok-tok on how to tackle climate change.

Di tok-tok dey follow one year of ogbonge weather events wia many climate records don dey broken.

Di event na COP, e mean "Conference of di Parties", di "parties" be di kontries wey sign up to di original UN climate agreement for 1992.

For COP28, di 28th annual United Nations (UN) climate meeting, goments dey discuss how to limit and prepare for future climate change.

Di summit dey happun for Dubai, for di United Arab Emirates (UAE), from 30 November until 12 December 2023.

One of di ogbonge tins wey top dis year tok-tok for di summit na Loss and Damage Fund.

For one surprise wey light up COP28, delegates don agree to launch one fund wey dem don dey wait for to pay for damage from climate-driven storms and drought.

Deals like dat dey normally enter last minute before dem dey fit dey seal am afta days of negotiations.

But COP28 President Sultan al-Jaber bin shake up di meeting as e bring up di decision to di floor on day one.

Di EU, UK, US and odas immediately announce dia contributions wey total around $400m for poor kontries wey climate change don affect.

Wetin be di Loss and Damage Fund?

Loss and damage mean di effect wey many kontries suffer from weather events wey link to climate change palava and dem no fit avoid.

Dis na like cases of rising sea levels, prolong heatwaves, desertification, acidification of sea and extreme events, like bushfire, species death and crop failures.