US President Donald Trump don begin im first major international tour of im second term as president and im don land for Saudia Arabia.
Dis na part of im visit to Gulf states ova di next four days for bilateral tok.
Today, Trump dey meet wit Saudia Arabia leaders wia dem go siddon tok some issues wey involve both kontris.
Meanwhile, Saudi Arabian Crown Prince Mohammed bin Salman wey dem sabi by im initials MBS, don welcome Trump for King Khalid airport, wit oda leaders wey follow am come
Trump bin come down from Air Force One, with Saudi military members wey dey gidigba beside a purple carpet wey dem lay for ground for di US president.
Also, Elon Musk wey be President Trump adviser and CEO of Tesla and SpaceX, dey among plenti VIP guests wey go attend di lunch wey di host kontri get for Riyadh royal court, according to di official participant list.
Both Trump and Prince Salman bin shake hands wen dem meet each oda as dem go one hotel for private meeting.
During di visit, di US president go attend coffee and tea service for di ceremonial blue room, lunch wit CEOs, bilateral meetings and one agreement signing, according to wetin BBC US partner, CBS News, reports.
Wetin dem go tok
During dis meeting between di two kontris, e dey expected say agreement for Saudi Arabia to buy more dan $100bn of US arms and oda military equipment dey di deals wey Trump fit announce on dis trip.
Missiles, radar systems and transport aircraft also reportedly dey part of di package.
Di US na longstanding arms supplier to Saudi Arabia, but dat relationship get gbege for 2021 wen di Biden administration stop to dey sell Riyadh offensive weapons, sake of concerns about di kontri role for di war wey dey go on for Yemen.
Anoda key focus of di trip go be to secure significant new investment for di US economy.
Dis new investments for di US from Gulf states, go help Trump to show im pipo say di "America First" agenda dey bring results.
Later on, Trump go attend one Saudi-US investment forum for Riyadh wey go feature CEOs from BlackRock, Palantir, Citigroup, IBM, Qualcomm, Alphabet, and Franklin Templeton, wit effort to draw top Wall Street and Silicon Valley leaders to Saudi Arabia.
Trump go den attend one summit of Gulf leaders for di city on Wednesday, bifor e go travel to Qatar dat same day.
E go end im four-day trip for di United Arab Emirates on Friday.











