You are here: HomeAfricaBBC2023 06 26Article 1792448

BBC Pidgin of Monday, 26 June 2023

Source: BBC

Wetin Jamb tok about 2022/2023 cut-off mark

JAMB na di Di Joint Admissions and Matriculation Board of Nigeria JAMB na di Di Joint Admissions and Matriculation Board of Nigeria

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don set 140 and above as cut off mark for 2022/23 admissions into universities for Nigeria.

Na Prof Ishaq Oloyede, Jamb Registrar tok dis one wen e dey address pipo for di 2023 Policy Meeting on Admissions to Tertiary Institutions and awards on Saturday for Abuja, Nigeria Federal capital Territory.

Prof Oloyede say di Board approve 100 as cut off mark into Polytechnics and Colleges of Education.

E explain say di figures wey im announce na di minimum score but say e no dey compulsory for di higher institutions to follow am.