Di UEFA Champions League don reach again wit different teams getting ready for di 2025/2026 season.
For dis competition, na 36 teams dey play and alreadi, evri qualified team don set for di draw.
Di group stage draw of di 2025/26 Champions League go take place on Thursday evening wia some prestigious clubs go sabi dia fate.
Teams like PSG, Man City, Arsenal, Bayern Munich, Liverpool, Atletico Madrid, Inter Milan, Barcelona, among odas go discover who dia opponents be.
How di Champions League formats be
Di Uefa Champions League format dey set for way wey be say na di top eight side go qualify directly for di round of 16.
Di teams wey finish ninth to 24th go compete for play-off and dem go comot di bottom eight.
For di new Champions league format each team go play eight matches – some home and some away.
Di first eight teams go get automatic qualification to second round.
Di teams wey dey nine to 24 position go play knockout playoffs while di losers go drop to Europa League.
Teams wey dey from 25 to 36 position go automatically comot from di competition.
Date, time and venue for Champions League 2025/26 season
Champions League draw dey di mind of plenti football lovers dis season as di League Phase go begin.
For di 2024/25, Arsenal win six of dia eight League Phase games wia dem finish for third place to secure spot for di round of 16.
Na PSG waya Inter Milan wit five goals to win di last Champions League 2024-25 finals.
Di draw for 2025-2026 League Phase go take place on Thursday, August 28, 2025.
E go take place for di Grimaldi Forum for Monaco.
Dem go andstream am live for UEFA website by 5pm UK, and BBC News Pidgin go also give una di full list of di draw.
Who fit face who for di Champions League draw
One of di rules for di Champions League draw be say one team no fit face dia fellow league teams.
E mean say teams for Premier League, La Liga, Bundesliga and odas no go face diasef for di league phase of di competition.
Na four pots dey and na from hia dem go draw up who go face who.
Pot one: Chelsea, Liverpool, Manchester City, Paris Saint-Germain, Real Madrid, Bayern Munich, Inter Milan, Borussia Dortmund and Barcelona
Pot Two: Arsenal, Bayer Leverkusen, Atletico Madrid, Atalanta, Villarreal, Juventus and Eintracht Frankfurt. More go join
Pot Three: Ajax, Napoli, PSV Eindhoven, Sporting Lisbon, Olympiakos, Slavia Prague, Marseille and Bodo/Glimt
Pot Four: Newcastle United, Pafos, Athletic Club, Galatasaray, Union Saint-Gilloise, and Kairat Almaty











