You are here: HomeAfricaBBC2022 10 26Article 1650848

BBC Pidgin of Wednesday, 26 October 2022

Source: BBC

'We need to create chances against Colombia' - Flamingos coach

File photo File photo

Nigeria under-17 women’s team get chance to enta dia first ever Fifa World Cup final. Di Flamingos go play Colombia for di semi-final wey go shele for di Jawaharlal Nehru Stadium in Goa by 12:00 on Wednesday. Nigeria beat USA 4-3 on penalties for di quarter-finals, while Colombia beat Tanzania 3-0 to qualify for di semi-finals. Anybody wey win dis match today don enta di final wey go happun on Sunday. 'We need to create chances' Head coach of di Flamingos, Bankole Olowookere don tell Nigerians to relax  dia mind say dem don ready well well to face Colombia. E tok afta dia last training session on Tuesday. “Na operation Colombia must go down and Nigeria must move forward, we want enta di final, and we no go fit enta di final if we no remove Colombia, “We dey do evritin possible to make say say we achieve our aim so dat millions of Nigerians go still get hope say we go win di Cup” Oga Bankole tok about dia chances to score plenti goals for di match. “We fit miss plenti scoring chances sake of say dis programme na to develop players, na gradual process, wetin dey important for us na make we create chances “ e tok Nigerian players morale dey high for dis game wit plenti ginger say dem go win. According to local media, Head Coach of Colombia, Carlos Quintero say dem get big opportunity to qualify for di finals. E add say dem no get any issues for dia side sake of say one of dia biggest players wey bin get injury don dey okay now. So as e be so dem dey ready to face Nigeria for di ogbonge semi-final match today. Flamingos bin lose dia first match 2-1 to Germany , dem beat New Zealand 4-0 and Chile 2-1. Colombia lose dia first match 1-0 to Spain, beat China 2-0 and Mexico 2-1 to enta di quarter-finals wia dem overcome Tanzania. Nigeria and Colombia don meet before? Nigeria play Colombia for di first time for Azerbaijan for 2012, di Flamingos beat dem 3-0. Di second time dem meet na for Costa Rica for 2014, di match end 2-1 in favour of Nigeria and dem use am qualify for quarter-finals. Na di first time di two kontris dey face each oda for semi-finals. Nigeria bin don qualify for three quarterfinals before di World Cup for India 2022, while Colombia neva pass group stage before now. ‘Sudden death’ Nigeria bin tink say dia pattern against USA for Quarter final fit work against Colombia. Di Flamingos bin use penalty qualify wen dem beat USA 3-4 Nigeria change dia goalkepper - Jiwuaku enta for Omilana. dem also bring in Offiong to substitute Bello for di last minute. All dat strategy no work. Jiwuaku bin prove why dem bring am in wen she save Munoz penalty kick but her heroic save no dey enough to carry her team enta final. Edafe wey bin get di last kick to give Nigeria victory fail to score. Her kick hit di bar. As di penalty enta sudden death, Nigerian defender shoot her kick go wide wey give Colombia a deserved victory. Penalty Kick: Nigeria 5-6 Colombia Rodriguez score for Colombia Offiong score for Nigeria Perlaza score for colombia Etim score for Nigeria Munoz miss. Jiwaku save am Usani score for Nigeria Espitaleta score for Colombia Afolabi score for Nigeria Caicedo score for Colombia Edafe miss. Ball hit bar Ortegon score for Colombia Oyinlola score for Nigeria Hernandez score for Colombia Forlorunsho miss. Agudelo catch am FULL TIME: Nigeria 0-0 Colombia Second Half: Nigeria 0-0 Colombia 90+5mins: Corner for Nigeria. Usani square di ball in but Colombia defend am comot. 90+3mins: Wetin Nigeria dey do now na to defend till di end of di game 90+1mins: SUBSTITUTION. Nigeria change dia goalkepper Jiwuaku enta for Omilana. Wit belief say di match go enta penalty Offiong also enta for Bello. 90mins: Corner for Nigeria. Simple save for Agudelo. 88mins: E be like say Nigeria wan escape dis pressure from Colombia for di regulation time. 86mins: Anoda miss by Caicedo inside Nigeria 18. Di ref later call for foul against Folorunsho 85mins: Foul against Afolabi. Na Rodriguez dey take di free kick for Colombia 82mins: Di Nigerian defence don hear am. Dem neva rest from di follow-up attacks of di Colombians 80mins: Nigeria try attack for di firs time since 2nd half start but Espiteleta stop dem. 78mins: Anoda good sve by Omilana. She save Caicedo spin from di left flank. 77mins: SUBSTITUTION. Gravatito enta for Quintero for Colombia 75mins: COOLING BREAK 74mins: Colombia no dey give Nigeria breathing space at all. Dem don dominate di midfield. 72mins: Colombia goalkeeper, Agudelo just dey on holiday. Di Flamingos neva test am since di beginning of 2nd half 70mins: Good save by Omilana afta shot by Caicedo. Nigeria almost concede own goal. 69mins: Colombia dey do evri tin to break di Nigerian defence. 66mins: OFFSIDE. Linesman catch Quintero for offside. 64mins: Corner for Nigeria. Di Flamingos no ue am well. Usani cross too deep. 61mins: Nigeria goalkeeper Omilana save hot shot from Munoz. Di ball go corner. 59mins: Corner kick for Colombia. Folorunsho head Caicedo ball go corner 57mins: Bello try find Ajakaye wey shoot di ball go wide. Colombia goalkeeper just di ball waka pass 55mins: Good skill by Munoz to comot di ball deom Folorunsho. 53mins: Ref don stop play afta Bello clash wit Ortegon 49mins: MISSED CHANCE. Munoz miss one on one chance wit Omilana. But e miss am 48mins: MISSED CHANCE. Munoz miss one on one chance wit Omilana. But she miss am 45mins: SUBSTITUTION. Ajakaye enta for Adeshina First Half 45+4mins: Mosaku don call for medical help afta Espitaleta hit her from back 45+2mins: Nigeria clear Colombia free kick comot. Di Flamingos don try regain dia possession 45mins: Nine attempt on goal for Colombia , 5 dey on target while Nigeria don get 8 attempts but all na off target 44mins: DISALLOWED GOAL. Nigeria 0-0 Colombia Colombia bin score but ref say na offside. 43mins: Edafe long throw from di right no dey enough to threaten di Colombain defense 41mins: FOUL for Nigeria. Guzman set leg for Mosaku. 40mins: Nigerian winger Usani shoot di ball from outside. But e go wide 38mins: Caicedo dey run down Nigeria defence from evri angle. 36mins: Rodriguez fall inside Nigeria 18 box referee say no be foul. VAR don also check, say no be foul. Nigeria don escape possible penalty. 35mins: Bello run through di Colombian defense but dem stop her before she enta 18 33mins: Game don resume afta di teams go on 2mins water break 29mins: HIT BAR. Mary Espitaleta freekick from 25 yards out hit bar. Colombia for dey one goal up 28mins: Yellow card for Etim afta she bring down Caicedo 25 yards out 25mins: MISSED Chance. Munoz miss goal opportunity afta beta cross by Rodriguez. She shoot di ball wide. 20mins: Game don resume wit Nigeria holding possession. 18mins: Espitaleta don go down. She neva recover from di head clash she get wit Etim. Medics dey attend to am. 17mins: Free kick for di Flamingos but Espitaleta clear am comot. 14mins: FOUL. Strong challenge on Etim by di Colombian defender. Ref no giv card despite di head clash 10mins: Colombia don try spend some time on di ball. ,unoz dey press di Nigerian defense 8mins: CORNER for di Flamingos but Colombia clear am comot. 6mins: Nigeria dey press Colombia. Dem dey dia box for more dan 3mins now. 1min - Dis semifinal match don start, Nigeria wear green while Colombia wear red. Nigeria U-17 vs Colombia U-17 lineup Nigeria XI: 1. Omilana (GK), 2. Edgar, 3. Usani, 5. Adesina, 6. Oyinlola, 7. Bello, 8. Emmanuel, 10.Afolabi, 12.Folorunsho, 18.Mosaku, 20. Etim Colombia XI: 1. Agudelo L. (G), 2. Espitaleta, 3. Motta, 13. Guzman, 8. Hernandez, 11. Caicedo, 9. Munoz, 16. Ortegon, 5. Perlaza, 18. Quintero, 10. Rodriguez.