BBC Pidgin of Wednesday, 16 July 2025

Source: BBC

'We dey bury pipo almost everiday now' - man tok afta 27 pipo die fresh attack for Plateau state

Photo of gunmen Photo of gunmen

Pipo dey live in fear and panic afta one fresh attack wey suspected gunmen carry out kill 27 pipo.

Tori be say most of di victims na women and children, for one early morning attack wey happun on Tuesday for Bindi (Jebu) village, Tahoss community, Riyom Local Goment Area of Plateau State northern Nigeria.

Plenty oda pipo wound for di attack.

National Chairman of Berom Youth Moulders-Association, Solomon Dalyop Mwantiri, yarn give BBC News Pidgin say di incident wey happun don bring back serious worry about how safe rural communities dey for di state.

"Around 5pm (WAT) on Monday, our pipo see suspicious movement of some suspected armed Fulani from one settlement wey dem dey call Bangai Fulani for the district. I sharply call di sector commander say na di distress call I receive.

"I call back again, dem tell me say dem don already see di suspected Fulani and say military don already take over di area."

E add say di attack wey kill 27 pipo including women and children happun on Tuesday.

"Around 3am, hundreds of dem enta di whole area. Di vigilante pipo try resist dem, and military position demselves for two different places.

Di attack lead to the death of 27 pipo, odas don bin wunjur, and also dem burn some houses."

E still tok say up till now, pipo still dey live for fear, and dat one don make dem no fit even do mass burial for di pipo wey die.

Mwantiri beg both state and federal goment make dem investigate how security pipo no fit stop di attack even though dem know say security threat dey for di area before di attack.

Di Chairman of Riyom Local Gment Area of Plateau State still confam di attack, say e happun wen pipo dey sleep.

E tell BBC Hausa say plenty pipo don turn homeless sake of di recent attack.

"Di villagers begin dey see torchlights for night, den pipo begin shout. Dem tell security say sometin wan happun. We neva identify all di pipo wey wound finish," e tok.

E still add say "Now everiday dem dey bury pipo, and everi wia pipo dey turn internally displaced persons sake of attacks.

For now dem dey get help from goment and some NGOs wey dey give dem food, clothes and oda relief items."

The local goment chairman beg pipo make dem calm down and no take law for dia hand.

"We dey always tok with Fulani and oda tribes as part of di way to find peace. We go still try make dem send more security pipo come di area."

Wen BBC News Pidgin contact Plateau State Police Command tok-tok persin, DSP Alfred Alabo, e say dem still dey gada information and dem go release press statement.

Timeline of attacks and killings for Platue central Nigeria

April 2025 - Anoda attack bin happun for Bassa local goment area of Plateau State, north-central Nigeria, according to wetin residents bin tell BBC Pidgin. Di attack bin happun for di early hours of Monday, 14 April between 1:00am and 2:00am. Yakubu Ventim wey be tori pesin for di state bin tok say di chairman of Bassa local goment area, Joshua Sunday Riti, bin carry some TV tori pipo wit plenty security to di community wia di attack bin happun. "Na about 38 to 50 pipo dem bin massacre for di village dis morning. "Dem ambush di community and kill mostly women and children," oga Ventim tok. May 2025 - At least 10 pipo die sake of kasala between herders and farmers for Riyom Local Goment Area of Plateau State. Tori pipo Channels Television bin report say from wetin start from farm destruction, cattle rustling, and attacks on livestock, pipo from both Fulani and Berom communities clash. Dem add say statement from Operation Safe Haven, confam say di insecurity for di council area bin start on Monday, May 12, 2025, wen suspected youths bin slaughter and rustle cattle wey bin enta dia farms for Dayan village, Riyom Local Goment Area. To take revenge, di herders attack Danchindo village on di evening of May 13, dem kill four people befor dem run as dem hear say police dey come. On May 14, di villagers bin kill 26 cows as dem dey para say dem kill dia pipo. Di herders later comeback again dat day, dem attack one settlement near Wereng Kam community, wia dem kill six locals. June 2025 - Di killing wey happun for Mangu Local Government Area of Plateau State, North central Nigeria wia mob kill some travellers, don cause serious reactions in di kontri. Di victims bin dey travel from Zaria for Kaduna State on Saturday to go attend wedding for Qua'an Pan Local Government Area of Plateau State, wen mob intercept dem for Mangun district. Some of di travellers die for di scene, while odas sustain different kaind injury, and dem dey hospital now for treatment. Authorities for Nigeria say about 13 pipo die afta some pipo ambush one bus wey belong to Ahmadu Bello University for Zaria.