Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results.
So therefore, dem don temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal.
Di examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results.
Dis dey come as di WAEC result checker portal dey shutdown and candidates no fit access dia results.
WAEC say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal.
Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem come back after 24 hours to re-check.
IMPORTANT NOTICE pic.twitter.com/fcnBCeovS8
— WAEC NIGERIA (@waecnigeria) August 7, 2025











