BBC Pidgin of Monday, 21 July 2025

Source: BBC

WAEC speak on report of cancellation of 2025 exam

WAEC say report say dem cancel all di papers for di just concluded WASSCE 2025 no be true WAEC say report say dem cancel all di papers for di just concluded WASSCE 2025 no be true

Di West African Examination Council (WAEC) say report say dem cancel all di papers for di just concluded West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) 2025 no be true.

WAEC say dem see news wia one supposed press statement wey dey fly up and down for social media dey claim say di federal ministry of education don cancel di examination sake of 'examination malpractice, leaked exam papers and unauthorised spread of exam materials.'

Di WASSCE 2025 papers bin take place few months back and during dat time, some conversation about malpractice bin come up.

For May 2025, students write di English Language paper 2 essay exam for di WAEC examination late into di night on Wednesday 28 May, 2025 wia parents say dem no happy wit dat kain development.

Dat particular paper suppose take place for afternoon but na for late for night dem write di paper.

Now, WAEC say dem no get hand for di press statemen wey dey spread for 19 July 2025 about cancelling di papers sake of exam malpractice and oda mago-mago.

WAEC cancel di 2025 WASSCE paper?

WAEC don come out to debunk di tori say dem no cancel di 2025 WASSCE papers wey students just write few months ago.

According to di statement by Moyosola Adesina wey be di head of WAEC Public Affairs department, e say di fake press statement on di cancellation of di examination no be from dem.

"We neva cancel di examination. Though we no sabi di source of dat information, di Council dey certain say di false claim dey spread from mischief-makers wey wan bring di Council into bad image."

Waec say di pipo wey dey spread di fake news wan cause confusion for di candidates wey sit for di examination.

Wen WAEC go release 2025 WASSCE?

WAEC say dem don begin dey mark di examination scripts and don conclude am.

According to dem, di 2025 WASSCE results na di next tin dem dey ready to release as dem don finish wit di marking of scripts.

WAEC say WASSCE results go dey ready and dem go release am for August 2025.

"As a matter of fact, we don conclude di marking of scripts of dis examination. Results go dey released on or bifor Monday 4 August 2025."

Pipo wey dey mark WAEC scripts na examiners wey be sabi pipo for di education sector wey sabi classroom work well-well.

WAEC go set up Committee of experts wey go come up wit marking guide, den drill all di appointed examiners well-well on all aspects of di marking scheme for one marking exercise wey dem dey call co-ordination.

Na how WAEC dey pick dia examiners be dat and na dat same process dem take mark di 2025 WASSCE.

Dis no be di first time wen pipo dey tok about exam malpractice for WAEC and di results.

For 2023, results of 262, 803 candidates wey write di 2023 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) dey withheld, according to wetin di council tok.

WAEC say di plenty results wey dem dey hold na those of candidates wey involve for examination malpractice and oda mago-mago.

Di 262, 803 results wey dem hold na out of di 1,613,733 candidates wey sidon write di 2023 exam.

For may 2025, WAEC for dia statement bin apologise to students for di delay in di exams wen dem write into di night.

Dem acknowledge say dem get some challenges during di conduct of WASSCE for School Candidate, 2025 wey include delay in di timely conduct of English Language Paper 2 dem write on Wednesday 28 May, 2025.

Dem say dem face some challenges primarily sake of dia major aim to prevent leakage of any paper, na why di paper happun for night.

Offence wey count as exam malpractice for WAEC

.Candidates wey carry books or cribs enta examination hall na offense

.To insult or assault any examination official na offense

.To swap scripts inside examination hall na offense

.To replace your answer scripts wit anoda one during or afta di examination na offense

.Impersonation dis one mean to write exam for pesin na offense

.To take part in mass or organised cheating for exam hall na offense

.Odas dey inside di Council Regulations & Syllabuses dem.

Wetin to know about WAEC?

Di West African Examination Council, na international exam for senior secondary school student wey dey happun every year.

Kontris wey dey write WAEC na, Gambia, Ghana, Liberia, Nigeria and Sierra Leone.

Na for 1952 dem establish am. According to information on top dia website, di vision of di West African Examinations Council na to be a world-class examining body wey dey add value to di educational goals of im stakeholders.

WAEC na West Africa ogbonge examining board wey dey established by law.

Dia work na to set, conduct di examinations and to award certificates wey dey comparable to dat of equivalent examining authorities internationally for di English-speaking West African kontris,.