You are here: HomeAfricaBBC2023 12 15Article 1899344

BBC Pidgin of Friday, 15 December 2023

Source: BBC

Video show moment gospel singer slump and die for stage as im bin dey minister

Pedro Henrique don die at di age of 30 Pedro Henrique don die at di age of 30

Brazil gospel singer, Pedro Henrique don die at di age of 30.

Di singer, record label management, Todah Music confam im death on dia verified Instagram account on Thursday.

Di 30-year-old na di only son, husband and papa to two months old pikin.

One video wey don go viral for social media show how di singer collapse ontop stage, as im dey perform one of im hit song, Vai Ser Tão Beautiful, for 1st Territorial Police Station (DT) of Feira de Santana, Brasil on Wednesday night.

Di gospel singer wit 1.2m followers for im Instagram page, still tell im fans for im story say im don arrive di location to perform before im go ontop stage on Wednesday.

Todah Music no reveal wetin cause di singer to suddenly collapse ontop stage on Wednesday.

Although, di record label say dem dey face difficult situation but dem no fit explain as dem understand say na di will of God go prevail.

Dem tok say Pedro na pesin wey dey jolli wit everybodi and di only son and super dedicated papa to im pikin.

Di record label send dia condolence to im wife Suilan, family and friends as dem commit to support im young family.

"We dey rejoice so many times togada, and now we dey cry wit dose wey dey cry," Todah Music tok.

"Di Christian music segment dey mourn. Todah music family dey mourn.

Heaven choir receive one illustrious son: Pedro Henrique! We go see you soon dear brother!!!"

View this post on Instagram

A post shared by Todah Music (@todahmusic)



Profile of Pedro Henrique

Pedro Henrique na Brazil gospel singer. Dem born am for July 24, 1993 for south of Bahia for Brazil.

E begin sing for di church choir at a very young age, but im begin sing professionally for 2015, wen im release a cover video for YouTube.

Di singer release im album "Great is the Lord" for 2019.

Di artist enta limelight wit im hit song Descendência, wey get ova 20 million views ontop YouTube.

Pedro Henrique don achieve great tins for im musical career as im get ova 200 million views for Youtube also 300 thousand pipo dey actively listen to im music evri month on Youtube

Di gospel artist marry Suilan Barreto, a make-up artist for March 2018.

Dem born dia pikin for 2023 afta im wife suffer miscarriage in 2021.